Bauchi State don drop better gbas gbos as dem approve monthly stipend for Imams and Pastors across the state. Dis one na official decision wey Bauchi State Economic Council carry come table, with Governor Bala Mohammed himself chairing the meeting on Friday, January 30. As dem talk am, e no be audio promise — na policy wey dem ready to run.
According to Head of Civil Service, Barrister Mohammed Sani Umar for Bauchi state dis stipend go cover Imams wey dey lead Juma’at mosque and pastors from different Christian denominations. Government say dem no dey choose religion or denomination — everybody go collect equal respect, no discrimination, no side eye.
Umar add say government still dey arrange the financial calculations well-well make the payment no turn short-lived enjoyment. As e be so, Bauchi State dey try balance worship, governance, and wallet — no be small thing for dis economy.
Emirs & District Heads No Go Beg Again, Salary Don Enter System
No be only clerics collect better news. Bauchi State also approve salary payment for newly appointed Emirs and District Heads. Meaning say traditional rulers wey don dey serve people no go dey use handshake settle transport again.
Barrister Umar talk say government don already put cash-flow plan in place, so the salary no go be promise wey go later turn “we dey work on am.” Once appointment land, salary go follow — simple arithmetic.
Observers say dis move fit ginger traditional rulers to focus more on peace, unity and community leadership instead of chasing allowance. As elders dey talk, “when stomach calm, wisdom dey flow.”
Bauchi State Ghost Workers Catch Cold: 3,000 Names Wipe Comot, ₦4.16bn Saved
As Bauchi state dey share stipend, dem still lock door against ghost workers wey don dey chop salary from spirit world. Governor’s Chief Economic Adviser, Alhaji Yahuza Adamu Haruna, reveal say payroll review expose over 3,000 ghost workers hiding inside salary structure like rats for store.
The audit, wey dem do with Onyx Investment Advisory Limited, help Bauchi State save more than ₦4.16 billion. Money wey ghost don dey chop before don now return to real human beings — progress with evidence.
Haruna still add say since August 2024, when state government take full control of salary payments, salary complaints don disappear like fuel subsidy. Workers dey smile, ghost dey cry — governance don dey make sense small-small.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
