Gbas Gbos don land for Kano Court as judge no gree smile at all. Four men wey dem talk chop life of one mechanic, Rilwanu Ilyasu alias “Nanu,” don collect final judgment — d£ath by hanging! The matter wey happen for Farawa Layout since April 2016 don finally reach its full stop after many years of courtroom wahala.
Dem four wey go face the rope na Abubakar Sadiq (wey dem sabi as Alhaji Sallari), Abdulmajid Jibrin, Nasiru Sani, and Yusuf Sani. According to the case gist, the men go Nanu house with axe and other weapon like say dem wan shoot action film. The court talk say the men plan am well-well, no be mistake or street fight.
The presiding judge, after checking all the witness talk, exhibits, and wetin lawyer yarn, come talk say evidence full ground like garri for market — no escape. He stamp him judgment: “Make dem hang till dem kpeme.” Gbas gbos justice don land!
Wetin Cause the Wahala: NDLEA Matter Enter Middle
As prosecution counsel Barrister Safiya Yalwati Yahaya yarn, the wahala start because dem four belle no sweet say Nanu allegedly report one o
dem to NDLEA. That tip-off na wetin make NDLEA arrest the suspect and collect hard drugs plus ₦27,000.
Anger enter body Luke and pepper soup without water — na so dem plan their revenge mission. Dem waka reach Nanu house that fateful night, carry axe and other weapon of mass destruction, and allegedly use am well-well till the poor mechanic no fit talk again. Nanu later kpai from the injury wey he collect.
The kano court hear from eight witnesses wey confirm say na dem really do the gbege, and even the axe wey dem use still dey as exhibit — no be gist, na fact! The lawyer talk say the case pain am because Nanu na ordinary hardworking mechanic wey just dey hustle him daily bread.
Kano Court:Two Don Japa, Four Don Jam Rope
While four don bag their hanging certificate, two of the suspects, Nura Farin Boss and Dan Bayo, still dey waka for free air. Police say dem still dey on the run since 2016, but investigation dey continue. Street people for Kano talk say make the remaining two no too believe say dem don escape — “law fit long, but e no go break.”
As the news spread, people for the area still dey remember Nanu as the cheerful mechanic wey no dey look for wahala. Some neighbours talk say dem hope this judgment go make street boys learn lesson say revenge no dey sweet at all — e fit end with rope for neck.
The whole matter serve as reminder say life no get duplicate. For Gbas Gbos corner, we go just summarize am like this — If person vex you, abeg go drink zobo, no carry axe.Kano Court no dey laugh o!
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
