Na wah o! Viral video don scatter internet as some people wey no be real candidates dey write ICAN professional exam for big men and women. One man wey dem call Kay (name wey we no go mention finish) knack uniform enter exam hall dey write on behalf of one bank manager. As if that one no enough, dem still catch one babe wey say she dey represent one government official from Taraba state. Na proxy season be this? Abi na new method of “remote learning”?
The kain thing wey dey happen for exam hall fit make pesin believe say na Nollywood script, but this one na reality show live and direct. People dey even ask: “Shebi na ICAN exam or na audition for Best Actor of the Year?”
ICAN Don Para, Say Integrity No Be Plaything
The Institute of Chartered Accountants of Nigeria(ICAN) no even smile at all. For one official statement wey the Registrar/Chief Executive, Mr. Lanre Olasunkanmi sign, ICAN yarn say their exam na global standard, no be backyard play. Dem talk say any kain impersonation or exam malpractice na red card straight!
Olasunkanmi clear throat talk say ICAN dey run zero-tolerance policy. Meaning say once dem catch you, no prayer or fasting go save you. He still stress say integrity dey carry heavy weight for their exam, and anybody wey wan bend the rule dey play with thunder.
Investigation Don Start, Punishment Go Land Sharp-Sharp
As e be now, ICAN don launch serious investigation into the wahala. Dem don swear say the matter no go sweep under carpet like dust. Anybody wey involve, whether na candidate, proxy or oga at the top wey send them, go face disciplinary hammer wey go fall anyhow.
Olasunkanmi still promise say when dem finish their digging, dem go carry everybody along with wetin dem discover. Translation: no hide-and-seek, no cover-up. The people wey dey guilty go collect woto-woto, and the wahala go serve as warning to others wey dey reason the same shortcut.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
