UK Admission: One young lady wey dey use X (formerly Twitter) don scatter internet with her gist. According to her, she just apply to four UK universities to “catch cruise,” no serious plan at all. She say she just wan try her luck, no be say she even reason say dem go gree her.
“My pipu, I no even get plan,” she yarn. “I just dey play, apply make I just see wetin go happen.” But as the result come land, e shock her like NEPA transformer – all the schools gree her!
Now, the babe dey reason say she go need pack her bags go jand, all because of cruise wey turn real life jackpot. Who say play no dey pay?
UK Admission: Social Media Pipu No Gree Rest – Dem Don Turn Her to Inspiration
As she drop her story online, na so social media pipu begin hala. Some dey laugh, some dey tap into her grace, while others dey ask which kind cruise dey give admission like this. One user even talk say, “Babe, abeg apply for visa for cruise again – maybe na Canada next!”
Some motivational speakers don hijack the matter, dey use am preach say “Just try! You never know.” Meanwhile, Twitter boys and girls don turn the girl to overnight role model.
Pipu even dey ask for her admission format, say make she help dem write motivational letter wey go catch oyinbo school heart. E be like say from play, she don become cruise coach.
UK Admission: Now Na Real Wahala Be This – Which School She Go Choose
As e be so, na four full UK schools dey beg her make she enter. The babe now get premium headache – how she wan choose among dem? Some dey offer better course, others dey give better location, one even talk say dem fit dash her small scholarship.
She yarn say, “I no even plan reach like this. Now I dey reason things like visa, accommodation, and wetin I go wear for winter.” Cruise don turn serious matter.
One thing sure be say, the girl don show say sometimes, play fit turn to purpose. Make we dey try things – who know, the next admission letter fit dey your spam folder!
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
