Wetin go make Nigerian Doctor for America wey sabi treat heart problem no fit hold e own heart wahala? Na wetin people dey ask as tori break say Dr. Ikenna C. Erinne, 36-year-old Nigerian cardiologist for America, don kpai e own self on January 26, 2025.
Dis oga doctor wey dem born for Naija on March 4, 1988, na beta family man wey love e pikin dem – Ugonna and Munachi. Im papa and mama, Engr. Chris and Mrs. Chinwe Erinne, plus im siblings, Chuks, Onyi, Kenny, and Gechi, all still dey cry e sudden death.
Dem don fix “Celebration of Life” service for Monday, February 3, 2025, for Gary L. Kaufman Funeral Home, Maryland, from 11:00 AM to 12:00 PM. After dat, dem go bury am for Meadowridge Memorial Park.
From Medical Guru, Nigerian Doctor for America Enter Wahala Wey Pass Prescription
Dis doctor no be anyhow person for medicine matter. Na Morehouse School of Medicine train am for 2015, plus im do residency for University of Maryland Medical Center. After dat, e still go do fellowship for Robert Wood Johnson University Hospital.
As cardiologist, im dey work with Capitol Cardiology Associates for Camp Springs and Lanham, Maryland. People wey sabi am talk say im be beta doctor wey dey care for im patients well well. But as life be, no be only medical wahala fit wound person, sometimes na life problem go strong pass injection.
Nigerian Doctor for America Enter Marriage Gbas Gbos Wey No Get End
E be like say di Nigerian Doctor for America marriage wahala don dey chop im body since. Reports talk say e and im ex-wife don dey fight for court over divorce and who go take care of their pikin dem. Court come order am make e dey pay $15,000 every month for child support, and e no be small money at all.
Dis heavy financial wahala, plus di emotional gbege wey follow, no let im mind rest. People wey near am talk say e don dey under serious pressure, and di thing fit don push am to make dis bad decision wey shock everybody.
Kidnap Wahala & Death Wey Scatter Everywhere
As e be now, wahala wey senior wahala don show face. Some reports dey talk say on di day wey im kpai, Dr. Erinne hold im ex-wife, their two pikin dem, plus nanny for house at gunpoint for three hours! Na when di nanny manage escape go call police, wahala come burst.
As police dey come, tori be say di doctor see say e fit enter big legal gbege for kidnapping with gun.
Instead of make e face di kasala, e kukuma end e own life.
Meanwhile, Nigerian businessman Francis Van-Lare don come out dey clear im daughter name for di matter. People bin dey talk say im daughter, Suzette Chibuogu, get hand for wetin happen, but im don swear say na lie.
Di death of di Nigerian Doctor for America, Dr. Erinne don make many people dey reason how di legal system for obodo oyibo dey deal with African men. People dey ask, “Di system dey fair? Abi na trap?” Anyhow e be, di matter don pain many, especially di medical world wey don lose one of dia best hands.
Na so di tori be. Wahala no dey finish!
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
