E be like say happiness for Nigeria don carry slippers waka go another country .
According to latest report, Naija don fall reach 106th position for 2026 World Happiness Ranking. Last year na 105, before that na 102 — meaning say the thing just dey drop small small like network wey no stable.
This report come out on International Day of Happiness, wey United Nations General Assembly create since 2012 to remind people say happiness sef na serious matter. Dem check 147 countries and ask citizens make dem rate their own life — and e be like say Nigerians no too rate am high this time.
No be say people no dey try laugh o, but with cost of living, stress, and daily “Nigeria will humble you” moments, e clear why the happiness level dey do shakara.
Africa Ranking: Who Dey Smile Pass Nigeria ?
For Africa side, some countries dey shine teeth pass Naija well-well. Mauritius carry first for the continent, ranking 73rd globally. Other countries like Libya, Algeria and Mozambique follow for top positions.
Even countries like Gabon, Côte d’Ivoire, Cameroon, South Africa, Niger and Tunisia sef manage pass Nigeria small — Tunisia even rank 105th, just one step ahead.
E come be like say Naija dey always near better position but never enter am. Like person wey dey queue for shawarma but shop close before e reach your turn.
Oyibo Countries Dey Chop Joy: Why Dem Happy Pass?
For global level, Finland still carry number one position for the ninth time straight — yes, nine years of steady happiness! Iceland, Denmark and Costa Rica follow closely. Na only Costa Rica no be European country for top five.
The report na work of University of Oxford Wellbeing Research Centre with help from Gallup and UN Sustainable Development Solutions Network. Dem use survey wey make people rate their life from 0 to 10 — and na from there dem calculate who happy pass.
Things wey dem consider include money (GDP), support from family and friends, how long people dey live, freedom, generosity and how corruption dey affect daily life. So e no just be “laughing and smiling” — na full package of better living.
At the end of the day, the big question remain: Na who go help Nigeria find this happiness again? Because as e be now, people still dey find joy inside memes, football, and weekend jollof
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
