Na gbangba gbe the House of Representatives don do as dem pass the Electoral Act (Amendment) Bill 2025 reach third reading, sharp sharp, as preparation for 2027 general election. The message clear: if you touch election result anyhow, law go touch you back—hard.
Under the new bill, anybody wey forge nomination papers, cook election result forms, or scatter election documents fit face 10 years for prison or cough out ₦75 million fine. Lawmakers say dem no wan hear story again—dem wan clean elections, no magic, no abracadabra.
Dem also increase punishment for other election wahala. If person misuse voter’s card, na ₦5 million fine dey wait am. For once, ballot box don get better security than some banks—no be joke.
House of Representatives:Over-Voting: Share the Loss, Face the Law
On matter_attach over-voting, House of Representatives talk say if votes pass accredited voters, dem go deduct the excess votes proportionately from all political parties wey participate. No more cancel everything and start afresh—everybody go feel am small.
But presiding officers no go escape. If dem allow over-voting happen, prosecution dey wait dem. Meaning say anybody wey dey polling unit must shine eye like torchlight; “I no know” no go work again.
However, lawmakers reject proposal to jail people for inducing delegates during party primaries. Dem fear say politicians fit turn am to political witch-hunt, so dem comot that one. Dem also remove plan wey say make fresh election hold anytime over-voting happen—Nigeria don get enough reruns abeg.
House of Representatives:Early Voting, Diaspora Vote Still on Hold
According to Hon. Adebayo Balogun, chairman of House of Representatives Committee on Electoral Matters, Senate and House go harmonise the bill and send am to the President for assent by second week of January 2026. So the race don almost finish for National Assembly side.
Balogun explain say ideas like early voting, inmate voting and diaspora voting no make am inside this amendment. Reason? Identity wahala and registration issues still dey ground. No be say dem no like am, but Nigeria never fully ready.
On result transmission matter, lawmakers talk say network problem no be excuse. Presiding officers must still transmit results from polling units as the law talk. Translation: if signal fail, find solution—democracy no dey wait for MTN or Glo.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
