Lagos Taskforce don show say dem no dey sleep as dem storm Ketu, Mile 12, Ikosi Road and even the 7UP environ come bundle 20 beggars wey dey turn road to market square.
According to wetin Taskforce yarn, the operation no be for shakara — dem say the level don too much as some beggars don dey block road sotey motorists dey learn patience by force.
Pipo wey dey waka for the area sef say dem no surprise. One okada rider talk say, “Everyday I dey dodge dem like say we dey play temple run. Today na today.”
The Lagos Taskforce carry all of dem enter motor, no long talk, no transport fare. Government say na to restore sanity for Lagos roads.
Lagos Taskforce: Ikosi & 7UP Axis Feel the Heat
For Ikosi Road and the 7UP environ, plenty residents clap hand as Lagos Taskforce bus dodge pothole, branch gutter and park well to pack the beggars.
Dem say the thing don reach stage where some beggars dey do shift work — morning crew, afternoon crew, night crew — lailai!
Lagos Taskforce oga talk say many of the beggars dey use small pikin join hustle, dey drag pipo hand for traffic light.
Government yarn say this kain scene no dey represent “Centre of Excellence”, so action must follow talk.
Government Warn Say Na Just Round One
Lagos government come drop final warning: “If una no wan hear word, make una expect Lagos Taskforce anytime, anywhere.”
According to dem, the wahala no be only about begging — some people dey use am cover up for pickpocket work and street disturbance.
Dem promise to begin rehabilitation for some of the vulnerable pipo, but for the stubborn ones wey dey form street lord, na Taskforce go continue their deliverance.
Residents for the affected area dey hope say this raid go reduce traffic, noise and the “dash me something” chorus wey don become national anthem for Ketu-Mile 12 axis.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
