Serious gbas gbos don bust as Delta Police Don Dey Chase human rights activist, Victor Ojie, aka Wong Box on top ₦4.8m Light Wahala With BEDC for Anyameluhor street, Asaba. Delta Police say dem dey find am after im allegedly assault Benin Electricity Distribution Company (BEDC) staff wey wan cut im light.
According to Delta police spokesman, SP Bright Edafe, the matter no be small as the guy dey face case of assault, threat to life and wahala wey fit carry Section 355, 86 and 249 of Criminal Code for head.
Dem yarn say around 11am, BEDC officials waka come area to disconnect customers wey no dey pay light bill. Na so dem reach Wong Box compound wey dem say im dey owe gbalaga ₦4.8 million light bill. Instead make bros gree, na so e para like Nollywood actor, rush the staff with cutlass, dey shout say dem must reconnect him compound sharp sharp. Na fear of cutlass make technician quickly on back the light, else e for turn obituary story.
The gbas gbos no stop there o, eyewitness talk say even one BEDC woman wey dey carry belle jam ground for the wahala. As if that one no do, bros still chase her with cutlass like action film. Na so confusion scatter everywhere.
Delta Police First Catch Am, But Bros Don Vanish Again
Delta Police confirm say dem first arrest Wong Box for the matter. Dem later release am on bail as na normal process, but since then, bros don ghost like say e travel go Jupiter. According to delta police tok-tok person, dem don dey look for am with serious manhunt wey go ensure say im face justice.
SP Edafe no even smile when e yarn say, “We no go rest until we re-arrest this suspect. The guy must face wetin e cause.” For police record, this no be ordinary small gbege, na serious threat of life wey involve pregnant woman, company staff, and almost bloodshed on top light matter.
People wey dey Asaba dey gist say na normal thing for BEDC staff to dey face harassment anytime dem wan cut light, but this one don pass boundary. Na why delta police dey chase the human rights activist like say e be action star.
Delta Police Tok N4.8 Million Light Bill: Wahala Wey Big Pass Generator Noise
The shocking part for the whole gist na say Wong Box dey owe close to ₦5 million light bill. Residents wey hear the matter begin ask how one person fit use light reach that kind amount. Some even dey joke say maybe bros dey run “small London” for inside him compound with free AC, cold room and industrial machines.
But na the cutlass drama make everything worse. Instead make am settle or find way negotiate with BEDC, bros decide to turn Rambo on top electricity wahala. Now na delta police dey hunt am like say na blockbuster season film.
As the gbege dey hot, the matter don raise question about how people dey react when light company show face. True true, many Nigerians dey vex on top light matter, but to raise cutlass for official hand na wahala wey dey carry free bus straight to court.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
