Abuja Security Guard David Moses Confess Say Dem kpai School Nurse & Baby Pikin for 250m Ransom

Abuja Security Guard David Moses Confess Say Dem kpai School Nurse & Baby Pikin for 250m Ransom

One security man David Moses,wey suppose dey protect children and staff for Clear Hope Foundation Academy turn to suspect for one ogbonge crime fear catch people for Abuja.
David Moses, the guard wey don confess, talk say na him and him padi, Sunday Irimiya, plan how dem go kíll school nurse Chinyere Anaene and one 14-month-old baby, Nanenther Asher Yese.

Dem carry out the evil act on top say dem wan collect ransom — dem first talk say na ₦250 million dem want from the families, before dem calm down to ₦3 million. Na so dem plan turn real life horror inside school compound for Dawaki, Abuja.

Dem Collect Ransom, But Wahala Still Burst

David Moses yarn say after dem collect the ransom finish, kasala burst as dem two begin drag how dem go share the money. Na so Sunday vex, carry knife stab am gbagam, comot with the full money, leave Moses to dey bleed.
David Moses still get small life remain, manage waka reach one house, tell the person wetin happen small-small (you sabi say fear dey), but insist say make dem carry am go police. Na so police rush am hospital before the full gist begin unfold.

He talk say, “Na for hospital dem begin ask me wetin sup. I start to talk everything from A to Z. Before that time, fear wan finish me, because I no sure say the community go even let me explain before dem finish me.”

Nurse Weh Show Kindness, Na She Dem kpai

This part go pain you pass. Moses talk say the school nurse, Chinyere, even give am food money that same day. But him wicked mind still follow Sunday plan evil.
David Moses explain say: “I go call her from class, tell her say I wan show her something. As we reach near toilet, Sunday jump comot from where him dey hide, put rope for her neck, begin strangle am. She struggle, but later her body weak.”

As if that one no pain reach, Sunday still insist say make dem carry the baby pikin too. Dem no stop there — dem still take the innocent baby life join.
Wetin Go Make Person Turn This Wicked?Now Nigerians dey ask: Wetin go make security man, wey people trust, turn to m¥rderer for ransom money? Money don really spoil plenty minds?


Discover more from OGM News NG

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Discover more from OGM News NG

Subscribe now to keep reading and get access to the full archive.

Continue reading