Yahaya Bello former Kogi state govnor, no go fit carry him international passport waka go UK go do medical treatment Na Federal High Court for Abuja’s tell am. The mata play out on Monday, July 21, as Justice Emeka Nwite drop him final judgement for inside court.
Bello bin tell court say e don dey battle hypertension for 15 years and him need beta care wey only UK fit give. But the wahala be say the medical paper wey him show as evidence no get signature from the doctor wey write am. Omo, na there kasala bust!
Justice Nwite yarn say, “See ehn, una talk say person need medical help, but una paper no even get signature. Na who we go believe now, ghost doctor?”
“No Be Abuse, But No Be Pass” — Court Drag Yahaya Bello Join Body
Even though the EFCC yan say Yahaya Bello dey use court anyhow, Justice Nwite no totally gree. E tell EFCC say dem no even fit quote correct law wey support wetin dem dey talk. In short, na ‘trial of vibes’ dem bring come court.
“The complainant lawyer just dey talk anyhow. E no bring any section for Nigeria law or even obodo oyibo law wey back him talk say surety must know or be party to motion,” Nwite talk, as e throway small gbas at EFCC counsel.
So while court no gree say Bello dey abuse court process, dem still no gree make him passport waka. As dem talk, “No be every excuse na emergency.”
Medical File Without Signature? Na Play You Dey!
Bello lawyer, Joseph Daudu, SAN, show two exhibit papers (A and B), talk say the document na clear evidence say oga no dey okay. But wahala enter as EFCC fire back say the matter na repeat version of wetin dem don already carry go FCT High Court before.
Dem say this new one no get head because even the sureties no get any info say dem wan carry passport. For EFCC mouth, the whole tin na recycled story with formatting error.
As e be like this, Yahaya Bello go need manage him Nigeria medicine or find better doctor for Wuse, because UK trip don jam legal roadblock!
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
