Hanan Buhari don come out say thank you to everybody wey forgive her papa after hin waka go meet baba God, even as Nigerians still dey debate wetin Baba Buhari do or no do, hin pikin
For one heartfelt interview with BBC Hausa, she yan say: “Wetin I go miss pass for my papa na him sense of humour. He dey always make us laugh even when we dey vex. I dey thank everybody wey put wahala aside forgive am. God go bless una.”
Hanan Buhari no even try form strong woman. She talk say the pain no be beans at all, but she dey take am as wetin Allah don write. “On top say we dey sad, we dey still say Alhamdulillah,” she talk with soft voice.
From ICU to Daura – How Buhari Take Bow Leave Life
Wetin many people no sabi be say before Baba Buhari finally close eye, he bin dey battle one kind sickness for long. Dem talk say na London he die on Sunday July 13, after dem discharge am from ICU wey he no too strong again.
Dem do the burial sharp-sharp for hin house for Daura, Katsina on Tuesday. But instead make everybody dey cry, some Nigerians enter social media dey drop hot takes – some dey praise, others dey throw jabs.
But as e be now, the matta don dey calm small, and people don dey reflect on both the sweet and sour moments of Buhari regime. Some say, “At least him try,” others still dey vex for subsidy matter.
“He Teach Me How to Pray, Read Qur’an” – Hanan Buhari Remember Her Papa
Hanan Buhari no just stop for thank you – she begin drop small small gist of how her papa raise her. “He teach me make I dey serious with school, make I dey pray, and make I dey do things wey go make people happy. That one I no go ever forget,” she talk with her hijab well arranged.
She even talk say she read Qur’an to am during him last moments. For her, that one na big privilege and she dey grateful say she fit dey by him side before he kpai.
“Life na vanity,” she add. “Na why I dey just thank God for the chance to be him pikin and to show am love before he go.”
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
