Yankee Gbas gbos don enter US student visa mata as the United States Mission for Naija don drop serious update: If you dey apply for F, M or J visa, your social media account must dey public! No more private settings, no more “only me” posts — dem wan see everything clear like early morning light.
According to dem official X handle (na the new Twitter), this new rule dey effective immediately. Anybody wey wan japa go Yankee for school or exchange program go need open all dem IG, Facebook, TikTok, and Twitter pages make dem fit see you clearly. If you hide am, bros, na red flag be that.
Why Dem Wan See Your Post Before Dem Give You Visa?
The US talk say dem no dey play with national security. Dem wan use your online behavior take know if you be person wey go respect law or person wey go do “wetin no good” when you reach their land. So if you don use your Twitter drag America or plan “End Yankee,” Omo, you fit kiss that visa goodbye.
Dem say the visa no be right — na privilege. So before dem give you green light to enter their obodo, dem must make sure say you no get any hidden agenda. Na why dem say, “Set am to public make we see your vibe before we welcome you.”
Nigerian Students, Sanitize Your Timeline or Forget Japa go yankee
This one na loud message to all japa hopefuls: go clean your page like say na immigration officer dey watch am now — because dem dey! If your Facebook na full of party pics and loud rants against US or politics, bros delete am or explain am. Na now motivational quotes go dey fly for timeline.
Even if your account private before, US don talk say dem want am public to “facilitate vetting.” You fit no like am, but na dem rule. If you no gree, dem no go gree give you your yankee visa. So my guy, do the needful before dem catch you with one “cancel-worthy” post from 2016.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
