Wahala wear sneakers again as actress Angela Okorie enter Instagram Live to yarn say she don finally forgive Mercy Johnson. According to her, na because she hear say Mercy dey sick na im touch her heart.
She say, “Dem tell me say the kind sickness wey Mercy get no be wetin I go even wish my worst enemy.” She come talk say she no go drag her again and she don close that chapter.
But pipu wey dey watch the live talk say Angela no just forgive quietly – she drop one kind sympathy wey get double meaning. As if she dey use person health matter take do soft shade. Hmm… online in-laws no gree o.
Regina Daniels No Hold Back – She Para Give Angela Okorie
Regina Daniels no waste time. As she see the clip, she enter her own IG space and give Angela one soft but sharp warning. She call the forgiveness talk “insensitive” and say Mercy no need that kind fake peace offering.
She write: “With all due respect, Aunty Angela… abeg no forgive. Because for this side, we no dey forgive. Continue your cruise but no forget say she get pikin wey strong. No dey shalaye!”
The way Regina Daniels fire her own back, e be like say na long time dem don dey gather this smoke. She stand gidigba behind Mercy Johnson like DSTV dish for rain.
Mercy Johnson Set Record Straight – “I No Get Cancer”
Inside all the drama, Mercy Johnson come out sharply to clear the air. She tell fans make dem calm down – she no dey battle any cancer or anything wey close to am.
Mercy no too talk plenty, but she make am clear say all these “I hear say” stories no get leg. She dey okay and she dey focus on her family and career.
Fans come dey praise her for her maturity. Some say if na dem, dem for don reply with vawulence too. But as e be, Mercy no join them for the gbas gbos – she dey on her peace and quiet level.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
