JP2025 Final Bus Stop Don Land for Tanzania – Love Wey No Dey Hear Language

JP2025 Final Bus Stop Don Land for Tanzania – Love Wey No Dey Hear Language

My people, love don finally carry Priscilla Ojo and Tanzanian fine bobo Juma Jux reach their last bus stop – for Dar es Salaam, Tanzania. Dis one no be regular wedding o. Na the final volume for their global love tour – dem don do Naija version, e remain dis Tanzania grand finale, wey happen for Tanzania

Juma Jux yarn say him plan say dem go still do wedding for Rwanda, but na Priscilla shout, “Abeg, I don tire!” And truly, who no go tire with too much pepper wedding? But dis one sweet pass, as dem invite people from China, USA, Nigeria, Kenya, even Uganda – like na United Nations of love matter dem gather for there.

JP2025: Celebrities Wey Show Face for Tanzania

Priscilla Ojo and Juma Jux no dey play as dem invite big names from Nigeria, Tanzania, Kenya, and beyond to come witness their love tori final chapter.
plenty celebrities for naija show face even tanzania no carry last as their own celebs turn up big time. show face to support Priscy and Jux.

JP2025: Juma Jux Gift Priscilla Range Rover – Love Wey Dey Vroom!

Juma Jux no carry last at all. As everybody dey chop jollof and snap picture near that cake wey big pass landlord house, oga Jux drop correct surprise package – one fresh Range Rover SUV, tear rubber!

Na so e be o! As dem dey do reception, dem unveil the motor like say na music video – Priscilla just hold head, shout, “Oh my God!” Love sweet pass sugar when e come with key and engine. Social media people nearly tear internet as video of the car presentation surface – everybody dey hail Juma say “husband material, 100 yards!”

Dis one no be ordinary wedding o – na premium celebration. With the kind gift wey Juma drop, some babes don dey find Bongo boyfriends. Bros no only marry wife, he package her with Range – na love plus motor, wetin remain?

The JP2025 wedding finale na true celebration of love, culture, and unity, wey bring stars together from across Africa wey come witness the union of Priscilla Ojo and Juma Jux.


Discover more from OGM News NG

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Discover more from OGM News NG

Subscribe now to keep reading and get access to the full archive.

Continue reading