Na serious gbege bust for Real Madrid Football Academy wey dey Elekahia, Port Harcourt, as Rivers State Police don arrest one 17-year-old boy wey dem say s3xually assault one 13-year-old JSS2 girl. According to tori wey reach us, the Rivers State Commissioner of Sports, Hon. Christopher Green, na him personally carry the boy go hand over to police.
The commissioner no dull at all. He call everybody wey get hand for the matter — the victim, the suspect, their mama and papa, plus school management — make dem yarn face-to-face for him office before he pass the case give Elekahia Police Division. E no be small thing o, because the matter don already cause serious talk among parents wey get pikin for the academy.
Real Madrid Football Academy Wahala:How the Gbege Take Happen
Real Madrid Football Academy Wahala:According to the elder brother of the victim, one Mr. Uche Sampson, the wahala start on October 22, 2025. He talk say the small girl bin go outside her hostel room to carry her clothes wey she spread, when the suspect allegedly attack her from back. Before she fit shout, the boy don hit her for back and dem enter small fight.
Na during that fight, dem say the suspect overpower the girl and allegedly do wetin no pure. The matter pain the family well-well because nobody expect say such kind thing go happen inside place wey dem trust to train children — both for book and ball. Now, police don dey dig deep to see wetin really happen and who go chop blame.
Real Madrid Football Academy Wahala:Commissioner Show Fatherly Love, Police Don Take Over
Real Madrid Football Academy Wahala:After the matter scatter ground, Commissioner Green show say he be true leader. The family of the small girl talk say the man handle the issue like papa wey no want see injustice. According to Mr. Sampson, “The commissioner really show care. He no just talk, he act fast to make sure justice go follow the right road.”
The Rivers State Police spokesperson, SP Grace Iringe-Koko, don confirm say the Elekahia Police Division don already start full investigation. She talk say dem go make sure the matter no go die down like other cases. As e be so, people dey wait to see how this tori go end — whether the boy go face court or whether another twist go show face.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
