Wetin go make pikin pass exam wey dem write for night? One Naija mama don burst out with serious gbas gbos as she react to the 2025 WAEC results wey just drop. According to her, the exam wey WAEC organize this year na like film for cinema — students dey write paper for dark like say na vigil.
The woman wey vex no hide mouth as she blast WAEC for doing things upside down. “English paper start for night, finish for midnight. Na who go pass like that? Na book or torchlight dem dey use read am?” she ask with fire for her voice. She come even talk say almost all the subjects wey dem write this year no follow at all — especially Maths and English.
She no stop there. Mama call all “good mothers” make dem come out join voice with her. “If e no concern you now, e go concern you later!” she shout. She talk say the kain failure wey happen this year dey suspicious and something must be done sharp sharp.
“Result Don Drop, But Wetin Be Dis Number?”
WAEC just release dem 2025 WASSCE result on August 4, and the koko no sweet at all. Out of over 1.9 million candidates wey sit for the exam, na only 754,545 students get five credits including English and Mathematics. If we wan break am down, na just 38.32% pass.
Compare am to last year wey about 72.12% pass the same level, you go know say yawa don gas. E be like say dem turn education upside down this year. People dey ask wetin really happen — na poor planning, na bad system, or na dem wan frustrate students join?
The same people wey write the exam dey cry say dem use candle light and phone torch do exam inside classroom. Some say dem write English Paper II and III around 9pm on May 28 — how exam go be like night shift for hospital? Na so dem expect better result?
“Mama Don Carry Megaphone – Say Make Everybody Shout!”
As result don show say wahala dey, the concerned Nigerian mama dey call on other parents make dem no fold hand. She believe say if dem no shout now, next year own fit worse pass. “All good mothers, come out o! Make we shout on top WAEC head before dem spoil our pikin future finish!”
She talk say education na national treasure and if we no guard am well, na we go suffer am later. According to her, the kind way WAEC take do things this year show say dem no get children interest for mind. “All the papers get k-leg, even the timetable no make sense,” she added.
As she dey shout, online people dey support am. Twitter, Facebook and even WhatsApp group don turn fire ground. Some dey suggest make WAEC officials explain how students take end up writing major papers for night. Some even dey beg Minister of Education make dem set up committee to probe the matter.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
