My pipu, kasala don burst for Nnamdi Azikiwe University (UNIZIK) as one student decide say na fight she go use take settle matter with her lecturer. The wahala start when oga lecturer jam her cruise, interrupt her video wey she dey record for class. As e be so, the babe no gree at all – she stand up, enter gbas gbos mode, and before anybody fit say “Jack,” body don touch body!
The whole drama no end for there. Other students for class just dey look like cinema show, some even bring out phone to record the wahala. Before person fit understand wetin dey happen, the matter don land for social media, and na so Nigerians begin para, talk say if she no get respect for lecturer, she suppose just go write another JAMB.
Nigerians No Gree – “She No Be Student Again
As the video land online, netizens no hold mouth at all. Some talk say she don finish her school career with that single action. “Make she just consider herself ex-student,” one Twitter user talk. Another one add say, “She no fit respect lecturer, how she wan take respect boss for work tomorrow?”
Others even drag UNIZIK management, say make dem no allow this kind behavior slide. “If na me be that lecturer, na straight expulsion letter she go collect,” another angry person talk. But some pipu reason am from another angle say maybe the lecturer sef do pass him power, but still, wahala no be the way to take settle matter.
She Fit Write Another JAMB – Gbas Gbos No Be Education
As e be now, e never clear wetin UNIZIK authorities go do about the matter, but one thing sure – wahala no be the way to get degree. Some pipu dey suggest make she beg, find way talk sorry before dem carry her matter go Senate.
For this life, no be every time person go dey do gbas gbos. Education no be by muscle, and if she no take time, she go use her own hand commot herself for school. Who sabi, she fit even dey plan to be lawyer or doctor, but with this kind character, na another JAMB she go write!
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.