Tragedy for Lagos:Na real gbege happen for Lagos as one 27-year-old woman wey dem call Aisha Maikudi Ibrahim lose her life after her motor waka go do akrobatics enter Lagos lagoon from Third Mainland Bridge.
Dem talk say the babe dey come back from Ikoyi around 1 a.m. after one event wey she do waka as vendor. Before the accident, she even call her mama tell am say, “Mummy relax, I go dey house in 20 minutes.”
But na so 20 minutes turn to 2 a.m., phone don off. Mama dey worry, sister dey panic, and by 6 a.m. the family don carry leg waka go Island begin search. Na there dem jam LASTMA, marine police and bystanders gather dey look lagoon like say na Netflix drama.
Tragedy for Lagos:Family Tears and Divers Weh Demand N400k Before Action
Tragedy for Lagos:When family reach the bridge, dem see say motor bumper dey float and plate number match Aisha own. Mama and aunty shout, “Na our pikin o!” But instead of quick rescue, na “we dey make call” gist emergency officials dey give.
Come see gbas gbos — na the papa of the girl gats go negotiate with local divers. Imagine say person still dey cry, but dem dey bill am like say na party package. Divers yan say dem no go dive until family drop N400,000 cash. After money change hand, dem finally enter water come bring out Aisha body between 2 p.m. and 3 p.m. — almost 12 hours after the crash.
Na so the family carry am go bury sharp-sharp according to Islamic rite. Wetin pain dem pass be say no be accident alone kill am, na the wahala of response join scatter everything.
Tragedy for Lagos:Life Cut Short,Family Remember Aisha as Hustler with Big Dreams
Tragedy for Lagos:For separate statement, Aisha aunty, Hadiza Oyewumi, talk say the girl no be anyhow person. She describe her as “promising entrepreneur” wey get plenty plan for future. But now, all the dream don cut short like NEPA light.
She come drag the matter say na pure “commercialisation of human lives” happen for Third Mainland Bridge that day. Instead of rescue, e be like say everybody dey calculate price like market women. Family still dey in shock, but dem hope government go sabi say rescue no suppose be luxury wey dem dey sell — na supposed be human right.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
