Naija music don show face again for Grammy Awards as our own Temilade Openiyi, wey everybody sabi as Tems, don win di Best African Music Performance category for di 67th Grammy Awards.
Di Naija superstar use her song Love Me JeJe take waka pass oda strong contenders like Tomorrow by Yemi Alade, MMS by Asake featuring Wizkid, Sensational by Chris Brown featuring Davido and Lojay, and Higher by Burna Boy.
Dis na di second Grammy wey Tems don win, and e sure say Naija pipo go dey jubilate as our music dey shine for international stage.
Na How Many Grammy Nominations Tems Don Get?
Tems no dey play at all! Dis year Grammy, dem nominate her for three different categories, and if we add everything join, e don make eight nominations for her career so far.
Aside di Best African Music Performance wey she win, she still show face for Best Global Music Album with her album Born in the Wild and Best R&B Song with her hit track Burning. Even though she no collect di oda two, na big deal say she reach dat level.
Meanwhile, South Africa’s Tyla na di first person wey win dis category last year with her jam Water. But dis time, Tems don hold ground!
Di Grammy Awards Weh Scatter Los Angeles
Di 67th Grammy Awards happen for Crypto.com Arena wey dey Los Angeles on Sunday night, and as usual, na star-studded event full of gbas gbos and premium entertainment.
As Naija music dey climb up, e don clear say Tem no just be ordinary artist again—she don cement her name for di international music scene.
Wetin we go talk? Tems don show say she be queen wey dey deliver back-to-back! Who go challenge am next? Time go tell!
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.