Fela Still Dey Pay Bills From Grave: Seun Kuti Collect $120k, Internet Burst Gbas Gbos

Fela Still Dey Pay Bills From Grave: Seun Kuti Collect $120k, Internet Burst Gbas Gbos

Seun Kuti don scatter internet after him yarn say he just collect $120,000 (about ₦180 million) simply because say na Fela Anikulapo Kuti son he be. According to am, even though Fela don waka go almost 29 years ago, baba legacy still dey cash out steady like salary alert.

Seun Kuti talk say the money no come from music show or endorsement, but na inheritance and royalty wey still dey flow because Fela name no dey expire. As e talk am, e sound like say Fela still dey for record label meeting from the spirit world, signing cheques with jazz background music.

Inheritance From Grave” Don Turn Online Cruise

As expected, Nigerians no dull. Once Seun Kuti drop that line say “inheritance from the grave”, social media turn comedy arena. Some hail am, say legacy na better investment pass crypto. Others say dem wan change papa urgently.

Seun Kuti no stop there. He add small gbas gbas by saying no Wizkid FC papa fit do that kind thing for their pikin. That line alone ignite fanbase wahala, as Wizkid fans begin defend Machala papa with full energy, even though the man no talk anything.

Legacy, Nepotism or Just Fact?

Some people say Seun Kuti dey brag too much, others say na simple truth. Fela build brand wey strong pass time, government, and even death. From music royalties to global recognition, Fela name still dey open bank doors for him children.

Whether you see am as privilege, inheritance, or pure legacy, one thing clear: Fela no die poor for relevance. Even for afterlife, the man still dey influence economy and online argument. Legacy wey dey pay bills na different level of ancestral pressure.


Discover more from OGM News NG

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Discover more from OGM News NG

Subscribe now to keep reading and get access to the full archive.

Continue reading