Skiibii Dares Juju Men: N5 Million for Anybody Wey Fit Prove Say Spiritual Charm Dey Work – Wahala Don Burst

Skiibii Dares Juju Men: N5 Million for Anybody Wey Fit Prove Say Spiritual Charm Dey Work – Wahala Don Burst

Jarvis talk say Skiibii no dey play this time o! The “Sensima” crooner burst internet with heavy gbas gbos after e drop open challenge give all native doctors, spiritual warriors and ogbonge baba alawo for street. Him yan say anybody wey fit prove say charm or spiritual protection dey really work go chop cool N5 million cash.

For him words, Skiibii talk say, “Make una bring una strongest juju wey dey stop bullet or make person vanish… I go give una money if e work!” This kain loud mouth don scatter social media. Some pipu clap for am, others dey drag him ear like small pikin wey chop meat from pot. Wahala wear agbada.

Internet Don Scatter: Nigerians Don Begin Drag ‘Village People’ Into The Matter

Na so X (formerly Twitter) and Instagram begin to roast. One guy wey call himself Baba Odi said, “Skiibii no sabi say juju dey work, na why him still dey find hit song since 2018.” Another person talk say make Skiibii go Yaba first go test him brain before e dey find juju proof like Inspector Gadget.

As usual, conspiracy theory don enter. Some talk say maybe e don get beef with one native doctor or maybe him just dey use clout chase to promote new music. Either way, fans dey laugh, trolls dey bark, and the juju community never drop response yet. Even witches group for WhatsApp never post statement.

Native Doctors & Street Prophets: “Skiibii No Ready for This Smoke!”

Meanwhile, one herbalist from Ogun State don yab Skiibii say, “You wan test our power? Come shrine, come chop kolanut first.” Another Instagram prophet sef talk say e go collect the money sharp sharp with holy oil and thunder prayer—e say no be only juju dey work, church back-up sef dey.

But some spiritual influencers don advise say make nobody take the bait o. According to them, spiritual matter no be comedy show. One even talk say, “If Skiibii mistakenly provoke the wrong spirit, na hit track from underworld go drop next.” Abeg oo! Who go win this juju vs Skiibii war?

If you wan test your village power or you dey sure say your grandpapa babalawo get legit charms wey dey work, opportunity don land. N5 million dey wait… but na your life you go use as receipt if e backfire.


Discover more from OGM News NG

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Discover more from OGM News NG

Subscribe now to keep reading and get access to the full archive.

Continue reading