Na wah o! Sheikh Gumi Ahmad don spark fresh wahala again as e talk say some Christian groups for Middle Belt dey bury empty coffin just to make e look like people don kpai for one kind genocide wey no happen. According to the controversial Islamic cleric, the whole drama na to make world pity dem and paint Islam black.
Gumi talk this one as e dey Turkey dey flex small, but na so critics begin drag am say e run from Nigeria because Trump talk say “Christian genocide” dey happen. Baba Gumi say lie lie! E no run, e just go do “pre-planned waka” for Turkey, no be escape mission.
According to am, one doctor send am gist say some people dey organize fake burial ceremony – empty coffin, fake tears, and camera crew – all to record “massacre” video wey dem go show foreign media. Gumi say, “Na desperation reach final level be that.”
“Na Anti-Islam Agenda Dem Dey Push” – Sheikh Gumi Para Well
The cleric no even try sugarcoat am. E talk am plain say all this wahala na “packaged script” to spoil Islam name and create bad belle against Sharia law. In Gumi voice, “Dem wan use lie lie genocide story take scatter peace and make Islam look like bad thing.”
As usual, social media don divide. Some people dey hail am say e dey talk truth wey people no wan hear; others say na propaganda wey go increase tension. But Gumi no send. Baba talk say e go continue to defend Islam from “media manipulators” wey wan turn religion to political weapon.
E add say the kind wahala wey dey happen for Middle Belt no be one-way matter, say both Christian and Muslim communities dey suffer from the same violence, but some people dey twist am to gain sympathy and foreign support.
Tinubu, Over to You – Sheikh Gumi Call Out Aso Rock Make Dem Face U.S.
As the matter dey hot, Gumi still carry am go international. E talk say President Bola Tinubu suppose vex small and show U.S. pepper for allowing Trump to talk that kain thing. According to am, Trump statement na “slap to Nigeria sovereignty.”
Sheikh Gumi even suggest say Nigeria suppose summon U.S. ambassador make dem retract the talk or consider cutting diplomatic ties if dem no respect us. “We no be their colony,” Gumi yarn, “make we diversify our friends – no be only America full this world.”
Now Nigerians dey gist for beer parlour and online: Who we go believe for this kind drama? Gumi wey dey talk say na “empty coffin movie,” or the people wey dey cry say na “real massacre”? Anyhow e be, this one don turn another episode of Gbas Gbos Chronicles: Nigeria Edition.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
