E be like say Nigerians no too sabi safety well well, abi dem just no even send safety at all. Na wetin cause dis Suleija tanker explosion wey kill at least 86 people now and still yeti deh count. Di tori begin for Dikko Junction near Suleija for Niger State. One tanker wey dey carry about 60,000 liters of petrol fall for di road. Di petrol begin leak, and before you sabi wetin dey happen, people don rush go collect di fuel wey dey spill.
Di problem come start when some people carry generator enter di scene. Dem wan use am transfer di petrol wey dey leak enter another tanker. Na so di generator kukuma spark fire, and di petrol catch flame is equal to gboa! Di explosion wey follow scatter everywhere, kill many people wey dey around, including children and bystanders.
Death Toll Don Rise Pass Wetin Dem First Talk for Suleija Tanker Explosion
As di Suleija Tanker Explosion happen, National Emergency Management Agency (NEMA) talk say di number of people wey die don reach 86. Di agency also mention say about 55 people still dey hospital dey find treatment.
One NEMA official, Hussaini Isah, tell di Associated Press say, “Some people burn so tey we no fit identify dem again. Di number of deaths fit even pass wetin we dey talk now until we do proper forensics.” E pain well well as di victims na people wey dey try scoop fuel, people wey wan look, and even people wey dey take picture for di scene.
Why Dis Kind Thing Dey Happen?
Dis Suleija Tanker Explosion no be di first one for Nigeria. Experts don link di problem to plenty wahala: bad roads, vehicles wey no dey maintain well, and di rising fuel price wey don make people dey desperate.
Since May 2023, fuel price for di country don increase by over 400% because government commot fuel subsidy. Dis kain economic stress dey make people dey risk their life to scoop fuel anytime accident happen. Many no dey understand di danger or dem just dey ignore am.
How Government Go Take Stop Dis Kain Suleija Tanker Explosion Wahala?
After di explosion, di Federal Government don talk say dem go carry di injured people go better hospital to treat dem. Dem also talk say dem don set committee to investigate wetin cause di accident and give advice on how e no go happen again.
Di government don also promise to do public awareness campaign to teach people say to scoop fuel from accident scene na dangerous thing. Dem dey try make Nigerians sabi say di life wey dem dey risk no worth di fuel wey dem dey try carry. Di message clear: “No near fuel spill accident area; e no safe at all.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.