Wahala don burst as Ogun State police don carry nine boys of famous singer, Habeeb Okikiola, wey everybody sabi as Portable, go face Magistrate Court for Isabo, Abeokuta. Dem say the matter wey land dem for court na because dem allegedly knack officers of Ota Zonal Planning office of the Ministry of Physical Planning and Urban Development.
The people wey dey inside this gbege na: Nurudeen Warris (21), Adetola Alashe (25), Samuel Adeleke (28), Oluwaseun Ayenuwa (19), Oluwapelumi Adeosun (20), Gospel Kanu (20), Precious Ohiegebo (19), Ifeoluwa Babatunde (27), and Fatimo Muhammed (26). Police say dem face five-count charge wey get to do with felony, assault, and restriction, plus say dem carry cutlass and gun, and even threaten to delete town planning officers. But when dem read the charges for court, dem all shout “we no do am!”
Police Yarn How Portable Boys Take Start Wahala
Police prosecutor, Sunday Ekong, open mouth talk say the gbege happen for Wednesday around 10:00 am for Oke-Osa, Tigbo Ilu, Sango-Ota. E say na Portable and him boys dem attack three town planners – Abidemi Onabanjo, Ramon Lateef, and Akinpelumi Oyero – wey dey do dem work.
As e be, the planners go Portable Odogwu Bar for check building matter when gbege start. Dem say Portable and him boys vex, carry weapons, block the officers, and even give dem better gbas gbos. E no end there, police say dem still do anyhow wey fit scatter peace for the area. Prosecutor talk say all dis wahala don break Ogun State Criminal Code law.
Magistrate Grant Bail, But Portable Still Para for Government
After hearing the case, Magistrate Mrs O.M Somefun come grant the defendants bail for N5 million each, but dem gatz bring licensed bondsmen wey Ogun State Government don register. The judge come shift the case go March 17 for further hearing.
Meanwhile, Portable don para for social media say Ogun State Government dey find him trouble. Him talk say dem don seal him uncompleted hotel and building because of “illegal development without permit.” Him claim say when dem raid the place, dem carry more than 20 people, including artists, customers, and even people wey just come see am.
Portable still talk say dem collect people car, bike, and phone. According to am, the place na event center, no be only beer parlour. As e be now, the matter still dey hot, and people dey wait to see how e go end.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.