Lagos State don finally vex for plastic palava. From July 1, 2025, dem go begin enforce the ban on single-use plastics. This one mean say Styrofoam packs, plastic straws, disposable cups, and light nylon bags wey tear like old wrapper go comot for street.
Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, yarn say this decision na because Lagos dey suffer from plastic palava. As coastal state wey dey below sea level, plastic waste dey block drainage, cause flood, and even affect marine life. Dem no just wake up ban Styrofoam in 2024; e get why.
Lagos no dey alone for this movement. Over 140 countries don already ban or restrict single-use plastics. Even Federal Government don announce plan to ban single-use plastics for government offices. But as e be Naija, we still dey wait for full implementation.
Plastic palava: Who Dem Dey Target? Mama Put, Office People & Even Your Side Hustle
Before you begin panic, make we clear am: the ban no include pure water sachets, PET bottles, and nylon bags wey thick pass 40 microns. So, if your nylon strong like Agbado campaign, you dey safe… for now.
punchng.com
But if you dey use Styrofoam plates, plastic straws, disposable cups, or light nylon bags, na you dem dey look. This one go affect Mama Put wey dey serve rice for Styrofoam, that man wey dey hawk sachet water, and even your own small party pack side hustle.
Office people wey dey order takeaway every 1pm, abeg get ready to carry your own plate like secondary school student. If you no gree, you fit soon dey eat for hand like old-school kings.
Plastic palava:How You Go Take Survive Now? Time to Go Back to Cooler Life
Abeg no panic, nobody dey send you exile. You just gats adjust small. Instead of nylon, try carry your own reusable bag or tote. Even those your mama old cooler fit come back to use now. Dem no dey leak and you fit still use am hold ice for weekend hangout.
E no go easy at first, but small small Lagosians go adapt. Na so we take survive COVID mask palava, this one no go kill us. Plus, imagine your street no dey smell again because nylon no dey block gutter. Your white sneaker fit last pass 2 weeks for rainy season!
So my people, no dull. Time don reach to save Lagos from plastic wahala – one plate and one bag at a time. If you no join now, e fit reach point wey dem go arrest you because you dey use nylon to wrap puff-puff!
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
