PDP Gbas Gbos | Fight Burst As Thugs Show Each Other Who Be Oga

PDP Gbas Gbos | Fight Burst As Thugs Show Each Other Who Be Oga

Trouble sidon jeje, PDP Gbas Gbos pipo don go poke am. My people, Abuja no gree calm again as PDP thugs wey dey loyal to Senator Samuel Anyanwu and Hon. Sunday Udo-Okoye knack better gbas gbos for inside their 79th Board of Trustees (BoT) meeting. The PDP Gbas Gbos wahala start as Anyanwu’s boys wey don already park inside hall see say Udo-Okoye don waka enter. As dem sight am, dem rush go tell the Ahmed Makarfi-led BoT Secretariat say, “Oga, dis man no belong here oo!”

Before person fit talk “wetin dey sup,” one of Anyanwu’s aides, Emmanuel Okoronkwo, show say e no dey joke. Baba just use hand arrange Udo-Okoye comot like person wey overstay for beer parlour. E manhandle am, push am enter outside, come dey dust hand like say na small work e do.

Udo-Okoye No Wan Gree, Reinforcement Land

As dem carry am commot, Udo-Okoye no wan hear say e don end like dat. Baba look left, look right, come hail him boys wey don dey hide outside. Before anybody fit blink, some of dem don even scale Secretariat fence like action film! Dem dey ready show say dem no come play.
But before dem fit match enter hall go rescue their Oga, armed security men wey don already gather, just block road. “Go back! No be una dey do meeting,” dem warn. With all the tension, dem manage press small brake for the kasala, so meeting fit go on small.

Army Truck Don Show to Settle PDP Gbas Gbos by Force by Tulasi!

Before the PDP gbas gbos, Anyanwu don first siddon for high table with BoT Chairman, Senator Adolphus Wabara, and Acting National Chairman, Umar Damagun. When Udo-Okoye waka enter with him blue native and red cap, e go find seat for another corner like person wey no wan near fire.
As meeting start, Senator Wabara beg everybody, “Abeg, mek we put party first before personal wahala.” Damagun sef no gree keep quiet; e use him own mouth tell party leaders say na dem dey pour petrol for PDP fire.

As at (1:35 pm) according to many reports, three Army pick-up trucks don show for Secretariat. Dem just park near meeting hall like dem dey wait to pounce on any-baga for ‘next round’ of the PDP gbas gbos. My people, na so we see am oo! Meeting still dey go on, but who know wetin fit sup next? Na PDP matter, anything fit happen!


Discover more from OGM News NG

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Discover more from OGM News NG

Subscribe now to keep reading and get access to the full archive.

Continue reading