E be like say Nigerian Army don too dey show dem pepper, fear com dey Catch Bandits for Naija. As di wahala don too much for inside bush, one notorious bandit leader, Kachallah Bugaje, don finally wave white flag. The man wey dem dey fear before, don change name to Zakiru Bugaje and talk say him no go do bad thing again.
For one video wey @ZagazolaMakama first share for X, Kachallah Bugaje talk say e don repent. E no just stop there, e even release 50 people wey e and him boys kidnap before. E say na fear of God make am change mind, no be say na money matter.
“I no go lie, we don kidnap plenty people, dey call their family, dey collect ransom. Some people pay 10 million naira, some pay 25 million naira. But as God touch my heart, we release all of dem without collecting shishi,” Kachallah Bugaje confess.
Nigerian Army Don Show Pepper, Fear Don Catch Bandits
E be like say gbas gbos wey Nigerian military dey give bandits don begin enter body. Army and other security people don dey scatter bandit hideouts up and down. Na so dem take make plenty bad guys disappear.
For the past one week, dem don neutralize 79 militants, arrest 252 people and free 67 hostages. As e be now, bandits no fit sleep close eye again because dem know say army no send anybody papa.
For Sokoto State, Nigerian Army 1 Brigade and Navy Special Boat Services waka enter Gebe village, Isa Local Government Area, go meet bandits for dia base. Dem clear seven commanders plus 24 bandits wey dey work with notorious Bello Turji.
Fear Don Catch Bandits, Who Wan Surrender Next?
As e be like this, bandit leaders don dey rethink their career choice. With the way army dey waka, e no go too tey before another oga for banditry go carry white cloth surrender.
For the past three months, military don clear 65 top terrorist leaders and rescue 1,854 kidnapped people. The plan na to scatter terrorist network so dat dem no go fit gather again.
Kachallah Bugaje use him repentance moment take hail Prophet Muhammad (PBUH) and even advise him former colleagues say make dem leave bad road before e go too late.
Wetin Go Happen Next?
As Nigerian army dey give back-to-back action, e clear say banditry no be sustainable hustle again. If army continue like this, we fit hear say some bandit leaders don apply for farming or tailoring work soon.
For now, people dey watch whether Kachallah Bugaje go truly maintain him new leaf or if na format e dey use to escape wahala. But one thing sure—this fight against banditry never finish, and gbas gbos still dey ahead.
Make we dey observe!
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.