Wahala be like bicycle as former Nigerian Idol winner, K-Peace, don cry give public say di big big money wey dem talk say e win, e never see shishi. Di musician yan say for national TV, dem talk say e win ₦7.5 million plus correct car, but as e comot for show, na only breeze dey blow for hin side.
E say e don wait sotay hin patience don finish, but no alert, no motor, no nothing. “I be dey happy say my life don change, but as I dey like dis, na trekking be my portion,” K-Peace talk as e dey para for social media. Fans wey hear di matter don begin ask, “Na audio money dem take deceive am?”
Di mata don cause serious gbas gbos as pipu dey wonder why big show go announce winner, spray confetti, but e go end for TV drama. Some pipu dey advise K-Peace make e go find lawyer, while others dey laugh say e don learn lesson.
Where Di Money Enter? K-Peace Ask Question
Di singer say no be say e wan bring wahala, but e just wan know how e take win money wey e never see. “E be like say na only for TV my account balance sweet, but for real life, e still dry pass Sahara desert,” K-Peace talk.
Some online pipu dey blame di show organizers, say make dem no dey use pipu shine without giving dem wetin dem promise. “If dem promise money, dem suppose pay. No be to dey do show wey go end for national TV but na empty hand di winner go carry waka,” one fan yarn.
Meanwhile, Nigerian Idol never talk anything about di allegation. Some pipu dey hope say na small delay, say di money and car go still land. But others dey fear say di mata don enter “come back tomorrow” level.
Gbas Gbos Don Start as Fans React
As di news burst, social media don catch fire. Some people dey advise K-Peace make e start to dey disturb di organizers, say “na who cry pass dey chop first.” Others dey yan say e suppose don get sense from past winners wey don complain before.
One fan talk say, “K-Peace no go use dis one take do remix? ‘I win money, I see car, but na only for TV!’” Another one say, “Make dem no turn di thing to Nigerian Wahala instead of Nigerian Idol o.”
For now, di mata still dey hot, and fans dey wait to see if di organizers go talk or if K-Peace go finally get hin millions and car. If dem no do anything, e fit be say another gbas gbos go soon land!
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.