My people, dem don tell us again say better dey come! Central Bank of Nigeria (CBN) Governor, Olayemi Cardoso, don talk say our GDP fit grow reach 4.17% for 2025. E talk this one with bold mouth on Thursday, as e dey ginger our hope say ongoing reforms and inflation wey wan calm down go help the economy waka up well-well.
But make we no lie, di gbas gbos wey dey beat Naija pipo too much! President Tinubu for 2023 commot “fuel subsidy” and devalue naira two times—e be like bitter medicine for mouth wey dey fix sickness but first, e go choke you. Na why inflation don waka go reach 34.8%. Cardoso still yarn say dem reforms go eventually help Naija GDP go up, calm inflation down as time go dey waka, and e go make life for Naija small-small better pass.
Oil Money Go Help Naija GDP, Reserves Wan Rise Small-Small
E no go surprise anybody say Naija dey bank on oil like say na bread and butter (Make we thank Dangote small for that one). Cardoso talk say foreign exchange reserves fit dey grow again, based on increased oil production wey dem target to reach 2.3 million barrels per day by mid-year. Abeg, na who no go like better oil money?
For 2024 sef, Naija see foreign exchange inflow pass $6 billion, and dem reserve climb reach $40 billion. This one dey give small hope, even as the struggle no dey hide for Naija people life. At least, if oil money continue to flow like this, e fit help us balance small for dis economic wahala.
Price Stability & Market Confidence: Na CBN Plan for Naija GDP
Cardoso no just stop for there, him still ginger hope say CBN go work hard to keep price stability and build confidence for market. Him talk say transparency and efficiency for foreign exchange market na wetin dem gatz improve.
As e be so, Naija people dey pray make all these numbers no come turn empty promises like person wey dey swallow air. E go make sense if this Naija GDP growth fit match beta life for street. Naija sef don tire for “e go better” without action—abeg make dem put body for road!
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.