Lagos people wey dey sleep early morning no expect say wahala go bust like this o! Soldiers wey just dey do their usual waka-jog near Myoung Barracks for Yaba wakka enter serious gbege as one driver wey dem suspect say don drink ogogoro, jam dem like film trick.
Army don confirm say one soldier no make am, while others Soldiers dey hospital dey receive treatment. Dem don carry the body of the Soldiers wey kpai go mortuary, while 81 Division Military Police don start full investigation to sabi wetin really sup.
Army Para! “We Still Stand Gidigba”
After the katakata, Army top oga, Major General Farouk Mijinyawa, don send him condolence to the family of the soldier wey kpai. E talk say e dey pray make the injured ones quick recover. But e no stop dia, e still tell people make dem relax say Army dey on top the matter.
GOC come use opportunity take yarn say nothing fit shake dem commitment to training and security work. Even as e pain dem, Army go still continue to dey secure lives and property for dia area of operation. Meaning say, even if wahala like dis happen, dem no go shake!
Drunk Driver & Him Guys Wan Japa – But Lagos People No Gree
As gbege burst, eye-witness dem talk say the motor wey cause the accident na Toyota wey carry three young boys. Dem say as dem dey speed like say dem dey Fast & Furious, na so dem jam soldiers like say na video game. Wahala come gas!
After the accident, the boys think say dem go fit escape, but before dem fit talk “Jack Robinson,” Lagos people don hold dem. Wetin remain? Gbas gbos land! Dem chop serious beating wey reset dem brain, plus dem vandalize the motor wey dem use jam soldiers. Talk say, one of dem even collect stab sef!
Panic Don Spread, Authorities Never Talk Anything
As the wahala wey the accident cause, leave four soldiermen wey dey Myoung Barracks for Morocco area of Shomolu, Lagos, don reportedly kpai, while others dey nurse injury, residents now for the area dey fear say e fit cause bigger wahala. Some people don dey ask whether Army go retaliate or whether Lagos police go fit handle the matter well.
As at the time wey we write this tori, Army spokesperson, Lieutenant Colonel Olabisi Ayeni, and Lagos Police PRO, Benjamin Hundeyin, never talk anything. Nigerians don dey wait make dem give official update because everybody wan sabi wetin go happen next.
One thing sure – wahala for who no dey look road well for Lagos!
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.