Mary Njoku Don Shout: “NAFDAC, Una Dey Sleep? Wetin Be Dis Drug Wey No Dey Work?”

Mary Njoku Don Shout: “NAFDAC, Una Dey Sleep? Wetin Be Dis Drug Wey No Dey Work?”

Mary Njoku Popular Nollywood actress and filmmaker, don raise alarm give Nigerians and government say di quality of drugs for Naija don fall yakata. According to her, she take some medicine recently and e be like say she swallow sweet, not drug. Di thing no even shake d turning belle wey dey do her for three days wey she Dey use the drug.

She carry her matter go social media, call out NAFDAC say dem need wake up from sleep. As she talk am, “NAFDAC abeg help! E be like say our drugs no dey work again. She add say na her husband wey just come back from abroad give her d same drug wey he bring come and the turning belle disappear in 5min,na him make her ask say Shey Na wetin we dey buy for pharmacy be this?” Nigerians wey don dey experience di same wahala begin share their own stories for comment section.

Nigerians React to Mary Njoku: “Na Herbal Mixture I Go Dey Use Now”

After Mary Njoku yarn her own, many Nigerians no hold back. Dem begin pour their own gbas gbos online. One person talk say e take antibiotics wey suppose clear cough, but instead di cough come strong like Wizkid’s fan base. Another person yarn say even paracetamol no dey reduce headache again.

Some people blame fake drugs wey full market, others blame government and NAFDAC for poor regulation. One aunty from Warri talk say na agbo (local herbs) go save person now because pharmacy own na scam. Gbas gbos everywhere!

Where NAFDAC Dey? Nigerians Wan See Action, No Be English

As di drug wahala don enter public front burner, Nigerians dey ask: “Where NAFDAC dey when all these expired and weak drugs dey enter market?” Dem say NAFDAC suppose dey do check-check, no be just dey issue press release.

Health na life, and many people no dey trust Naija medicine again. Mary Njoku don spark better national conversation. E remain make authorities carry this matter serious, because e no go funny if Panadol begin dey work after 3 days. Na small thing remain make people start dey import paracetamol from Ghana.


Discover more from OGM News NG

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Discover more from OGM News NG

Subscribe now to keep reading and get access to the full archive.

Continue reading