Eight days o, na im Sunday Omisakin use waka around after Govnor Adeleke carry big heart pardon am for Christmas period. But as dem say, wahala no dey use calendar check date, Omisakin don find him way back to Ilesa prison—this time, na because of one fine plasma TV.
Dem say di man dey no. 8 for Govnor Adeleke mercy list wey dem sign December 26, 2024. But instead make e use di pardon enter 2025 jeje with sense, Omisakin decide say him New Year resolution na to upgrade him TV taste.
Police Catch Am Red-Handed After Him Thief
Police yan say di kasala burst on January 3, 2025. Inspector Kayode Adeoye talk for court say, “Around 12:00 p.m. for Al-Medinat Area, Iludun, Osogbo, Omisakin waka enter Shittu Damilare house uninvited. Before anybody fit shout, ‘who dey there,’ e don carry plasma TV wey dem value as N600,000.”
Na di plasma TV sef wey no get insurance dey cry for background as police arrest am. By di time dem reach station, e don turn matter for court. Omisakin face two counts: burglary and ‘TV hug gone wrong make I no just talk e thief am.’
Lawyer Beg, Prosecutor No Gree
As court session start, Omisakin deny say e do di wahala. Him lawyer, Najite Okobe, beg di court: “My Lord, abeg give am bail for most liberal terms. Na New Year, make we start with kindness.”
But di prosecutor no even wan hear am. Inspector Adeoye vex: “Ehn ehn? Govnor just pardon dis man few days ago o! Him never even finish di original prison sentence wey Magistrate Olusegun Ayilara give am. E no even chop di first second chance well, now e dey come beg for third chance? For who side?”
TV Sweet, but Jail Time Sweeter?
Dem talk say di offence wey Omisakin commit dey under section 411 (1) (2), 363, and 390(9) of di criminal code cap 34 vol.II laws of Osun State of Nigeria 2002. Meaning, di punishment no be beans at all.
Magistrate Adekanmi Adeyeba gree with di prosecutor and order make dem keep Omisakin for Ilesa Correctional Facility until further notice. As di courtroom clear, one observer yan say, “Na wa o. Na e be like say he miss James Bond movie for his first prison term, and he no fit wait before he thief plasma screen to watch latest 007.
Now, di question be this: wetin sweet Omisakin for plasma TV pass di sweet taste of freedom? Abi na di jail food sweet so teh e wan go back go enjoy?
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.