Lagos State Government don yan say dem no go sit down fold hand again dey look trailers turn Lekki-Epe Expressway to parking lot. From August 1, dem go launch revised e-call up system wey go control truck movement. If trailer no get permission from app, na wallahi, no entry!
According to dem official talk-talk person, dis version na “beta, faster, smarter.” You no go dey enter like you dey drag ticket for Danfo, na technology go dey regulate your movement. As you dey approach, dem go know. If your turn never reach, abeg park well before taskforce park you.
No be say we never hear promise like dis before sha, but Lagos don swear say dem go back dis one with better monitoring. If your truck driver no sabi how app dey work, better hire small Gen Z boy make e help una, before una enter fine wey pass trailer value.
Lagos State Government Begins Operation “No Be Your Turn, No Move” for Trailer Drivers
E don tey wey pipu for Lekki dey use horn and insult do morning devotion. But now, Lagos State Government don finally get sense say enough is enough. With dis revised e-call up, dem dey tell all trailer drivers: “If we no call you, no come. If you come, na tow truck go carry you go station.”
Dis kind plan dey sweet residents belle. One Mr. Tunde wey dey sell car battery for Jakande side talk say, “Before now, trailer go block my shop, customer no fit enter. But if dem fit control am, I go buy gala for Sanwo-Olu.”
Even Bolt and Keke drivers don dey hopeful say di road go free at last. But some pipu still dey look dem with one eye, say “Make we wait see if no be another e-joke be this.”
Lagos State Government Begins Tech-Driven Move to Scatter Trailer Wahala with App
Di e-call up system no be wash. Lagos State Government say dis na correct digital solution powered by IT gurus wey sabi code pass traffic light. Every truck wey wan enter port must register online, get e-permit, and move ONLY when dem slot reach.
If you no register or wan form stubborn, dem say LASTMA and Taskforce go chase you like you thief container. Di app go even help track fake permits and illegal entry. So no chance for one-corner bribe waka again.
Dem promise say dem go do public sensitization join—make trailer drivers and companies sabi how the new system go work before August 1 land. No be say you go blame your village pipu when you park for 3 days because your permit no valid.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
