Kogi government don show say dem no dey play with security again as dem demolish several bandit camps across the state. According to reports, the joint operation between local vigilantes and security forces catch plenty suspects wey don dey terrorize people for different communities.
Governor Usman Ododo talk say the move na part of the ongoing war against criminal elements wey no wan allow peace reign for Kogi. He praise the security agencies for their gallant work and promise say the operation go continue until every corner of the state dey safe.
The demolition no be small thing as eyewitnesses confirm say soldiers and police invade the forests where bandits dey hide, burn down their tents and collect dangerous weapons from dem hand.
No Safe Place for Bandits Again!” – Kogi Goverment Vow to Clean Kogi Finish
Governor Ododo don swear say no bandit go fit rest for Kogi again as long as he dey kogi government house. He talk say his administration go continue to support security agencies with everything wey dem need to keep the state safe from kidnappers, armed robbers, and terrorists.
According to am, the operation wey dem carry out na the beginning of many more actions wey go wipe out criminals from the state. He also beg community leaders make dem cooperate with security operatives by giving useful information about suspicious movement.
The governor add say peace and progress no fit grow for where fear dey. “Any person wey no wan peace go face the full wrath of the law,” he talk confidently during his press briefing.
Residents Hail Kogi Government – “At Last, We Fit Sleep with Two Eyes Closed”
After the operation, joy full the air as residents of affected areas hail the kogi state government for taking bold steps. Many people talk say dem don dey live in fear for months as bandits dey disturb their farms, roads, and even markets.
One farmer for Dekina area yarn say, “Before, we no fit go farm without fear, but now, we dey see soldiers and police everywhere. We thank the governor for this bold move.”
Another resident from Kabba talk say the demolition of bandit camps don restore peace and confidence back to the people. Dem beg Kogi government make dem no stop the fight until the whole Kogi free from bandit wahala.
For social media, Kogi youths dey jubilate, praising the move as “real leadership in action.” Dem say this na the kind of governance Nigeria need across all states.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
