Ibom Air Palava: Wahala burst for air on Sunday, when one passenger wey dem call Comfort Emmanson turn the whole Ibom Air flight from Uyo to Lagos into WWE ring. As plane land for Lagos, instead make she waka jejely, na so she begin para for crew members. Story talk say the gbege start because she no wan off her phone wey dem tell all passengers to off for safety sake.
Inside aircraft, Comfort no just use mouth vex — she use hand join. One female flight attendant chop her slap, and before anybody fit say “fasten your seatbelt,” airport police don show. Dem bundle madam enter airport shuttle like overripe plantain wey dey go market.
Tunde Moshood, Special Adviser to Aviation Minister Festus Keyamo, even yarn for him X handle say, “She no just vex, she don carry her holiday go Kirikiri.”
Ibom Air Palava: AON Don Give Am ‘No Fly’ for Life
Ibom Air Palava: As if Kirikiri no do, the Airline
Operators of Nigeria (AON) don use hammer seal Comfort fate — she no go fly for Nigeria again, either home or abroad, till Jesus come. According to Prof. Obiora Okonkwo wey talk for AON, dem no go gree make passengers dey use crew staff train karate for sky.
The statement talk say, “We no dey joke with our crew members’ safety. Comfort case na warning for anybody wey wan turn airplane to fight club.” Dem even remind people say this kain thing no be first time — from KWAM 1 wahala for VajueJet to Senator Oshiomhole hot exchange with Air Peace staff. E be like say some passengers don forget say sky no be street corner.
Ibom Air Palava: From Social Media Fame to ‘Cooling Off’ in Kirikiri
Ibom Air Palava:Now, Comfort don go from trending video star to prison tenant. The Lagos airport gbege still dey scatter internet as videos show her throwing hands like she dey audition for action film. But unlike film wey get happy ending, this one end with prison gate.
She go dey ‘cool off’ for Kirikiri Correctional Centre while court matter dey continue. And as AON don stamp ‘No Fly’ on her head, the only flight she fit enter now na imagination airline. The moral of the gist? For plane, obey instructions or prepare to use prison bed as seatbelt.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
