Guardiola Boys Don Fall Yakata Combust Like Buredi for Rain: Arsenal Gbas Gbos Dem 5-1

Guardiola Boys Don Fall Yakata Combust Like Buredi for Rain: Arsenal Gbas Gbos Dem 5-1

E be like say Guardiola boys, (Man City) don forget how dem take win league before, because di kain waya wey Arsenal give dem no be here. Dem start di match dey form boss, but na so so yeye defense dem dey do. Erling Haaland manage score one wey balance di game, but na like say na pepper dem go rub for Arsenal eye, because di gbas gbos wey follow after no get part two.

As Thomas Partey shot knack John Stones body enter net, Guardiola Boys just waka comot for di match like person wey dem pour cold water. Before dem fit say “Rodri injury,” Arsenal don arrange dem wella, tear net anyhow. Guardiola face be like person wey dem collect hin food, as hin boys no fit even stand di pressure. Na which kin wahala be dis?

Small Pikin Lewis-Skelly Show Haaland Say Football No Be By Muscle

Arsenal boys dey reason say dem no go gree make Liverpool run comot with league, so dem enter field dey para. But na 18-year-old Myles Lewis-Skelly wey shock everybody pass. Di boy just dey run City midfield like say dem no even dey, before e come score hin first senior goal. Emirates stadium nearly burst with shout!

One of the Guardiola Boys, Haaland fit still dey ask who be dis pikin, because last year e don look di boy from head to toe ask “Who you be?” Oga Haaland, abeg meet Lewis-Skelly, di same boy wey just show you say football no be by who get big chest. Na small pikin wey run you and your papa teammates enter one corner.

K Havertz: From “Abeg Shift” to “Oga You Try”: Take Guardiola Boys Shine

If redemption na person, e for answer Kai Havertz name. First half, di guy miss one chance wey even Arsenal fans no fit defend am—dem dey look am like say hin don bet against hin own team. But football sabi do strong thing, because second half, Havertz wipe one better left-foot shot wey no give Ederson any chance.
From zero to hero, di guy don dey show Arsenal say e no just come collect salary, e dey work. Na hin goal just help Arsenal put final sand sand for Guardiola Boys garri. Guardiola go dey reason how person wey dem call flop don turn hin nightmare.

Nwaneri Come From Nowhere, Burst Net Like Say Na Training

If Arsenal academy be film, na blockbuster dem go call am. Na 17-year-old Ethan Nwaneri wey use final bullet finish Guardiola Boys. As Declan Rice give am correct pass, di boy no even shake—e just bend di ball enter net like say na normal thing. Confidence no be hin mate at all.
Imagine say big big men like Walker, Stones, and Dias dey field, yet na Arsenal small pikin wey dey finish dem anyhow. City don turn to biscuit wey any small breeze go just scatter. Meanwhile, Arsenal don send better message give Liverpool: “We still dey come for dat title!”

Pep Guardiola Headache Don Turn to Migraine

Pep go need Panadol after dis kind embarrassment. Hin team no just collapse, dem disappear entirely. Defense dey leak like fowl wey rain beat, midfield no sabi wetin dem dey do, and na only Haaland dey try struggle for front. Pep face be like person wey hin pikin break TV—confusion everywhere.
With Real Madrid match dey come, Guardiola suppose dey fear because if Arsenal small boys fit run am like dis, wetin Mbappé and hin gang go do dem? Guardiola Boys, (Man City) and dem fans fit still dey hope say na small problem, but di way e be, if dem no arrange quick, wahala go jam dem from all angles.


Discover more from OGM News NG

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Discover more from OGM News NG

Subscribe now to keep reading and get access to the full archive.

Continue reading