E no dey clear what really happen, but gbas gbos land for United Airlines, Lagos to Washington Flight 613. Four passengers and two crew members collect injury Pápàpá as di plane wey carry 245 passengers plus crew suddenly shake anyhow for air on Friday.
One passenger traveling on the Lagos to Washington Flight 613 use im phone record di whole palava as trays, food, and other items scatter for plane floor like market ground. People wey get injury no too bad sha, dem carry dem go hospital for Lagos, treat dem, and release dem sharp-sharp. United Airlines talk say di Lagos to Washington plane even do emergency U-turn go back Lagos. Na wetin cause di wahala still dey unknown, but di airline talk say no be turbulence wahala.
No Be First Time This Lagos to Washington Plane Don Dey Misbehave!
Dem say wahala no dey finish, as di same plane don show us trailer before. Reports show say earlier dis week, di same Boeing 787 plane wey dey fly Lagos to Washington, divert again after e drop altitude sharp-sharp. FlightRadar24 report say di plane drop like 1,000 feet for di other trip. Wetin dey cause di sudden acrobatics for air, we no sabi yet.
United Airlines don dey work with authorities for US and Nigeria to find di root of di problem. But e don clear say dis Boeing 787 get small “wahala spirit.” Di Federal Aviation Administration (FAA) sef dey keep eye for dis kind matter since one Latam Airlines Boeing 787 sef do mid-air dive last year.

“Gbas Gbos for Lagos to Washington Flight , but Passengers Still Dey Okay”
As di drama unfold, di Director of Public Affairs for Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA), Michael Achimugu, talk say dem thank God say no life lost. Passengers wey dey stranded don enter hotels to cool temper while United Airlines dey find new flights for dem.
Meanwhile, e be like say this Boeing 787, dis Lagos to Washington Flight don dey drag reputation anyhow. FAA don even issue advisory make dem dey check di cockpit seat switches because one plane nose dive last year after di pilot seat waka shift go jam di controls. Di whole matter dey suspicious, but for now, everybody dey thank God say na injury and no be RIP story.
Las Las, flying no be small thing o! Make we dey thank God every time we land in peace.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.