ECOWAS don decide say time don reach to fast-forward their standby force deployment as tɛrror wahala dey spread like harmattan fire. According to di ECOWAS Commission Oga, Omar Touray, di matter don pass play—e no dey only affect Sahel and Lake Chad again, e don waka enter di whole region.
Touray yarn dis one for United Nations Security Council on Monday as e raise alarm say di threat don turn regional gist wey need regional response. “Di danger don big, and na only better teamwork fit match am,” na so di oga talk am.
E also explain say di bad gangs no dey only carry gun waka again—dem don upgrade to “economic warfare.” Dis one mean dem dey block fuel for road, choke trade, and scatter transport lines. E be like say di militants wan use economics finish everybody join.
Standby Force Don Ready Boots – From 1,650 to 5,000
To take handle di matter, Touray reveal say ECOWAS go first deploy 1,650 soldiers as advance squad. From there, dem go kuku increase reach 5,000 troops as di need dey rise.
E talk say di operation go enjoy support from regional and international partners. Meaning say nor be only West Africa go carry di load, dem dey expect backup from big bros dem for outside.
But Touray still raise one big concern: too many countries dey do their own anti-tɛrror plan without coordination. According to am, “Everywhere full with initiatives, but di plenty plenty plan don begin scatter cooperation.” In short, everybody dey fight di same fight, but nobody dey synchronize ringtone.
‘Make We No Dey Form Big Man—Collaboration Na the Key’
Touray give final warning say even if dem bring trailer-load money and equipment come, e no go solve problem if people nor gree work together.
E talk say di current division inside West African politics dey allow militants take advantage. According to am, “Our differences nor suppose divide us—na bridge we suppose build, no be boundary.”
For final, e beg di UN Security Council and international community make dem provide better, steady funding and help strengthen security frameworks for West Africa. As e be so, ECOWAS dey ready, but money and cooperation go determine how far dem fit go.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
