E be like say Niger, Mali and Burkina Faso don bite pass wetin dem fit chew. Dem talk say dem no wan do again for ECOWAS marriage, but e be like say dem never ready pack commot finish. As today don reach, dem suppose don waka go, but fear don dey catch dem small-small.
Na last year January 28 dem first announce say dem wan comot, say ECOWAS no dey do wetin e suppose do again. Dem even form their own crew wey dem call Alliance of Sahel States (AES). But e be like say this breakup no go easy, because wahala full ground. Regional trade go suffer, security go weak, and the entire West Africa go feel the heat.
Security Wahala: Who Go Help Fight Terrorists Now?
As Niger don comot, e be like say na free ground dem give Boko Haram and other bad gangs for Sahel region. Before before, Niger dey help coordinate security waka for West Africa, especially for the fight against terrorists. Now wey dem don waka, who go fit balance the fight?
To make matter worse, na so so wahala France military own self dey get for Sahel region, as dem sef don comot. Now, places like Ghana, Togo, Benin, and Ivory Coast dey fear say the katakata fit spread enter their side. Wetin ECOWAS go do now to stop wahala from bust? Na serious gbege be this.
Trade and Visa Palava: Who Go Suffer Pass?
Before now, ECOWAS be like one big compound wey anybody fit waka enter without stress—no visa, no border wahala. But as these three countries don japa from the group, e fit mean say dem go need visa to enta some places, and dem fit begin pay extra money for trade.
Another big gbege be say over 132 people from Niger, Mali, and Burkina Faso dey work for ECOWAS. As dem don comot, e fit be say dem go lose their job just like that. Shey na dem sabi? Abi dem go still beg to come back later? Time go tell.
For now, ECOWAS don talk say, “If una don break up, abeg carry una load waka before deadline reach o!” Na to watch as dis gbas gbos go end.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.