Jonny Just Dey Com: Government Don Open Gate to Welcome Naija Deportees Wey Trump Dey Clear for U.S

Jonny Just Dey Com: Government Don Open Gate to Welcome Naija Deportees Wey Trump Dey Clear for U.S

As Oga Trump dey ginger him ICE people to clear immigrants wey no get correct papers like end-of-year everyone must “clearance sales”, Naija government don open hand dey wait make him own pipo ‘Naija Deportees’ wey dem wan deport come back house. If journey deh pursue you, house no dey fear pikin make e no enter. Nigerians in Diaspora Commission (NiDCOM) don talk say Federal Government dey ready to welcome our obodo oyibo returnees.

Na NiDCOM Director of Media and Corporate Affairs, Abdur-Rahman Balogun, talk this one for interview with Vanguard on Tuesday night. E say na Ministry of Foreign Affairs dey run this parole, and dem don even set up special committee wey go handle the Naija Deportees matter.

According to am, the inter-agency committee wey dem arrange include Ministry of Foreign Affairs, NiDCOM, Ministry of Humanitarian Affairs, plus office of National Security Adviser (NSA). If e be say deportation go happen, dem go dey ground to manage am well.
But make nobody fear, Balogun talk say dem never hear say US don start dey bundle Nigerians enter plane. But sha dem ready anytime wey Trump wan discharge Naija Deportees.

Trump No Wan Gree, Naija Deportees Dey for Sure!

For Yankee, wahala don wear agbada as Trump dey use ICE arrange deportation. Documents wey US Immigration and Customs Enforcement (ICE) release show say 3,690 Naija Deportees (Nigerians) don enter one kind deportation waiting list.

According to the figures wey dem see inside the report, as at November 24, 2024, dem don mark about 1.4 million non-citizens wey go collect “Go Back to Your Country” letter. Mexico and El Salvador even worse pass, with 252,044 and 203,822 people respectively wey don enter final removal list. We dey surprise say OGM News and the GBAS GBOS News collaboration never see any list wey contain pipo from Europe. Na dat one we take know say “Olomo kilo fomore” The Trump immigration affair go gbas gbos well-well.

As ICE people dey para, dem talk say dem no wan hear story. Their work na to protect Yankee from illegal immigrants and wahala wey fit threaten national security.

She Government Ready Tru Tru Sha As Naija Deportees Dey Worry

For Naija, dem don balance dey wait. Even though some people dey vex say FG never too prepare for how dem go help these returnees settle back, government dey talk say make everybody relax, dem go handle am.

Meanwhile, last week Thursday, ICE don already begin dey waka dey arrest migrants anyhow, and some people don even fly commot inside military aircraft. Trump talk say this na just the beginning, and more people go soon collect deportation letter.
For now, Nigerians and other African people wey no get complete paper for US fit be next target. As e be so, if your paper never complete, e fit make sense to start dey check how body go be.
One thing sure—gbas gbos full ground, and Naija go dey wait make e people land.


Discover more from OGM News NG

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Discover more from OGM News NG

Subscribe now to keep reading and get access to the full archive.

Continue reading