Na so gbege take start for Lagos as one senior police officer, Owolabi Akinlolu, 56-year-old Deputy Superintendent of Police (DSP), land for Kirikiri after dem accuse am say e rape 17-year-old girl for hin office. Wahala be like bicycle, e no dey hard to start!
The tori be say, the girl dey find her phone wey one-chance thieves carry when she dey return from Ikeja with her granny and siblings. Na so Officer Owolabi come shine hope for her say dem don catch the thief wey carry the phone. The innocent girl rush go station, no know say she dey waka enter lion den! As she land for the oga office, na so e lock door behind am… Wetin happen next na Gbas Gbos!
Deputy Superintendent of Police Case Turn Family Begging, But Magistrate No Gree
As the matter cast for town, the girl mama, Madam Aramide Olupona, cry come outside say police people wan cover the matter. She talk say dem dey use corner-corner beg make she drop case because the man wan retire for December 2024. But how you go retire in peace when you don use uniform do shege?
As dem carry the case go court for Ogba, the prosecution no gree. Dem come nak Magistrate O.O. Fagboun one seven-paragraph affidavit wey talk say dis kain badness no fit waka free for Lagos. Under Lagos Criminal Law Section 137, dis matter na gbese wey no be ordinary begging go fit solve. Na so Magistrate look the man from up to down, come order say make dem go keep am for Kirikiri Maximum Prison make breeze touch am small before the next hearing wey dem fix for March 11, 2025.
From Ogudu Police Station To Kirikiri – When Power Pass Power
Officer Owolabi, wey suppose dey protect people, don turn suspect for the same law wey e suppose uphold. From Deputy Superintendent of Police for Ogudu to inmate for Kirikiri, e be like Nollywood film wey script writer add twist! People for Lagos don dey talk say how police go dey find thief, come turn thief wey dey steal person dignity?
As the case don enter court, Nigerians don dey wait to see if justice go really balance for scale or if power go pass power. But one thing sure – the wahala wey Owolabi find, e don see am. Kirikiri no be barracks, and inside cell no get AC. Na to siddon look as trial go play out.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.