NDLEA Burst Popular TikTok babe, CandyTeddy, wey her real name na Praise Nwogu,as she don enter serious gbege after NDLEA knack arrest for Benin City on Saturday, November 22. According to tori, dem catch am with her partner-in-brownie, Ebong Emem Oghosa, 25 years old, as dem dey allegedly produce and sell brownies wey no be ordinary snack — na dr¥g-laced package dem dey distribute.
NDLEA Director of Media & Advocacy, Femi Babafemi, drop official statement on Sunday, November 23, confirm say na true true the arrest happen. The gist don scatter TikTok and X as people dey ask how brownies take turn to “knock person battery.”
As dem grab her, NDLEA say dem see 12 plates and one cup of the special brownies wey don pass NYSC kitchen level. Her guy man, Ebong, no escape too — dem meet 76 grams of sk¥nk, 1.5 grams of C@lorado, plus more of the dr¥g-mix brownies. Na full combo arrest dem collect.
Social Media Don Turn New Marketplace for Oshofree Wahala
This arrest don open another chapter for Edo State security matter. Authorities dey para say plenty youths don dey use social media to run small small illegal business wey dey smell dr¥g. TikTok wey suppose be for dance, cruise and “how-to-make-pancake,” don turn some people to apprentice pharmacist.
Government agencies dey waka round now, dey monitor pages, dey mark accounts, because e be like say some people don turn influencer lifestyle to influence wrong thing. One gist be say, na TikTok promo even help dem track how the brownies dey trend underground.
As NDLEA don drag CandyTeddy enter spotlight for wrong reason, many people dey yarn say this one go serve as warning for others wey dey use ring-light do backyard drug expo. “Shine for camera no mean say you go shine for cell,” one resident talk.
Investigation Still Dey Hot – More Names Fit Drop
NDLEA never finish the matter o. According to dem, investigation still dey boil like Edo banga soup. Dem dey trace the network, dey check who dey supply wetin, who dey distribute what, and who still dey hide for back dey run the operation.
Authorities talk say the aim na to scatter the entire dr¥g network wey dey operate for Edo State. Dem no want only arrest face-of-the-brand; dem plan collect the whole team, from supplier reach “brand ambassador.”
Meanwhile, CandyTeddy fans dey confuse online — some dey defend her, some dey shout “RIP to her career,” while others dey ask who go take over her dance challenge. But as e be now, the only challenge wey matter na “How to survive NDLEA interrogation 101”.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
