Canadian Armed Forces (CAF) officers don begin waka comot from uniform life as housing and health-care matter don turn real-life horror movie. One internal report wey dem call “Evaluation of Canadian Armed Forces Retention” expose say more than 10% of troops for 2024 alone don dey relocated go places wey house no dey, doctor no dey, even job for spouse no show.
Dem talk say anytime dem move these soldiers go new town, na new set of gbege. No house, no clinic, no person wey go look pikin, and spouse wey suppose find job go just dey look ceiling. Instead to dey jump from base to base like kangaroo, many soldiers don kukuma hang boot.
To worsen matter, waiting lists don long pass Lagos traffic. Daycare wait time reach 32 months, housing line long pass fuel queue during scarcity, and health-care? If you no get long life, you fit expire before your turn reach.
“Unfit for Human Being” – Auditor General Para for Military Houses
Na Auditor General Karen Hogan burst the truth on October 21 audit. According to her, some military houses no be house—na abandoned museum. She talk say some toilets no dey function, buildings dey peel like old akara, and one structure even date back to 1930 — the same era when your great-grandpapa dey toast your great-grandmama by letter.
The report show 3,706 Canadian Armed Forces (CAF) members dey wait for only 205 available units. If to say na Nigeria, dem for say “government no rate us at all.” Imagine almost 4,000 people dey drag less than 300 houses. Even raffle draw get better odds.
Junior ranks don dey suffer most. Attrition rate for young officers and parents don climb reach 9.4%. People don talk say instead make dem dey endure suffering, e better make dem find normal job wey no go break their mental health.
Canadian Armed Forces (CAF): Big Landlord With Bigger Problems
Wetin shock people pass be say the military na Canada’s second-biggest landlord with 21,000 buildings, but almost 25% of these buildings don old sotey them need resurrection, not renovation. Many infrastructures don pass 50 years and no fit meet basic safety or environmental standards again.
Researchers talk say the wahala dey affect family income, mental stability and career stability. Dual-income households dey plenty now, so anytime soldier move, the whole family dey enter new stress. No wonder people dey run comot like say dem dey escape winter.
The question wey everybody dey ask now: “How military wan retain soldiers when dem no fit retain decent bathrooms?”
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
