Canada immigration wahala don enter another level as fresh report show say dem don bounce more than 1,596 Nigerian asylum claims between January and August 2025. Out of the 3,548 Nigerians wey try run go Canada with asylum request, only 2,292 people get green light, wey make am like 65% approval rate. Na better pass from before, but still plenty Naija people dey carry “try again next time” letter.
Nigeria still dey top list of people wey dey rush go Canada follow countries like Mexico, India, Haiti and Colombia. Na insecurity from Boko Haram plus serious economic gbese dey push plenty Nigerians to waka go find new life. Most of dem wey get small luck dey land for Ontario and Alberta, two provinces wey don turn small Naija extension.
But dem no dey just give anybody chance. Immigration and Refugee Board (IRB) dey follow United Nations refugee rule wey mean say if you no dey face torment, torture or oppression for Naija, dem fit bounce you sharp sharp.
Who Canada Dey Approve and Who Dem Dey Bounce?
The asylum mata no be “waka enter, collect passport” kind gist. Canada dey look well before dem approve anybody. Dem dey consider people like women wey dey run domestic wahala, LGBTQ+ community, and people wey dey live with HIV/AIDS. Anybody wey wan try must first submit claim for port of entry or meet immigration officer before IRB go check am well.
But the problem be say many Naija people no sabi the rules wella. Some dey waka enter irregularly, some no carry correct documents, and na why rejection plenty. If you no balance your file well, dem go just tell you “baba, no vacancy for you here.”
From 2013 reach 2024, dem don reject 13,171 Nigerian asylum claims while dem approve 10,580. 2019 be the year wey rejection break record with 3,951 cases. Even for 2024 alone, 811 Nigerians chop rejection, while 2,230 manage hammer approval. Na clear say e no easy at all.
Experts Dey Yarn – Naija People Must Wise Up
Migration experts dey always shout say Nigerians suppose wise up for this asylum matter. Imaobong Ladipo-Sanusi, wey be oga for Women Trafficking and Child Labour Eradication Foundation, yarn say the major gbege na say “plenty Nigerians misunderstand refugee law.”
According to her, documentation na key. If you waka anyhow or show up without correct papers, dem go bounce you straight. She add say migration suppose dey safe, orderly and regular, and anybody wey truly dey run from wahala suppose get protection.
Last year, Naija even rank number eight for countries wey dey succeed with asylum claims, after Turkiye, Mexico, Colombia, Iran, Pakistan, Haiti, and Afghanistan. So e no mean say all hope don finish — na to sabi the process, package your case well and pray make luck shine for you.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
