One man wey dem no go mention him name (make im family rest small) don shock entire office after dem discover say he don chop ₦300 million like Sunday jollof rice. But na wetin pain everybody pass be say, he no buy house, he no buy car – he carry all enter sports betting!
Na when accountant begin see minus for company account like say na exam result, alarm blow. Investigation begin, and e no take time before dem trace am to oga gambler wey believe say e fit turn Messi with odds.
According to reports, the guy no even dey win the bet. E just dey press “Stake” like say na ATM dey refund immediately. Pipu still dey ask: “300 million? Bros, you no even win at least bicycle?”
300 Million: Betting Wey Supposed Be Fun Don Turn Career Ending Wahala
Colleagues wey work with am talk say the guy dey quiet, always wear headset – dem think say na work e dey concentrate on. Dem no know say e dey monitor live scores like stock market. One HR babe talk say, “Na me help this guy do onboarding! I no know say na odds e go carry us enter sack letter.”
Experts don dey shout since say betting addiction na real wahala. But bros no hear. As e collect small promotion last year, e just increase the bet amount join. “From ₦1k to ₦5 million per slip, just like that!” one IT guy lament.
Pipu don begin raise question say how company go get one person with access to that kain money without check and balance. As usual, dem don set up “panel” – make we no lie, we sabi how that one dey end.
Social Media Don Catch Fire – Nigerians Don Turn Am to Betting Meme Lord
As the news hit street, X (formerly Twitter) scatter. One user post say, “If him use that ₦300 million play Baba Ijebu, he for don buy land for Jupiter.” Another one write: “300 million? My brother, you no even try correct 3 odds? E pain me.”
Betting companies sef don join subtly. One post from popular app say, “Always stake responsibly – or your name go appear for newspaper like Mr. Office Jackpot.”
For now, bros dey under investigation. HR don lock e access card, colleagues don delete am from WhatsApp group, and e wife reportedly carry children go her mama house. This na lesson for all wey dey think say bet dey pay pass salary – sometimes e fit collect both.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.