Lecturers wey dey under Academic Staff Union of Universities (ASUU) don finally carry their red biro drop for ground. Dem don invoke their own version of “No Pay, No Work,” as Federal Government never still pay dem their salary. As ASUU take talk am, “Who go dey teach book for hunger? No be beans!”
The wahala wey start since dem return from one kin suspension of strike never still end. Instead of salary, na silence ASUU dey get from government. Na why dem don blow final whistle say dem no go step inside classroom until alert enter like correct morning devotion.
ASUU say dis one no be strike, na simple principle: “You no pay, we no work!” According to dem, dis Federal Government matter don turn to ‘dey play.’ Dem say lecturers no be NGO staff wey go dey dash knowledge for free.
Students Dey Cry – School Don Lock Like Christmas Church
For many campuses across Nigeria now, lecture hall don turn to ghost town. Students wey don manage come back school dey waka like zombie, dey find lecturer like NEPA light. One student for UniJos wey no wan make dem mention him name yarn say, “I just resume and dem don resume wahala again. Who do us dis thing?”
Another student for UNILAG shout say na ASUU and FG dey use dem do ‘Catch Cruise’. “If dem like make dem play ludo on top our destiny, but make dem know say person wey no graduate no fit blow,” the guy talk as he dey roast plantain to survive.
Meanwhile, some students don carry their wahala go social media. Hashtag like #BringBackOurLectures and #FederalGovernmentPayASUU don start trend again. As dem dey talk am online, “How we go do NYSC when we never even graduate? Na spiritual service?”
FG Dey Form Busy – ASUU Say Make Dem No Try Am Again
Federal Government on the other hand still dey form busy-busy like say dem dey prepare for world cup. Up till now, no clear statement don come out from dem side. Na only spokesperson wey talk say dem dey “looking into the matter” — which na FG code for “Abeg forget am.”
ASUU no gree that kind ‘government grammar’. According to dem, this kain behavior fit make dem carry full-blown strike enter next season. “You no dey owe senators, but you fit owe lecturers for months?” ASUU President para as he drop hot statement like Egusi soup.
Na so the matter be for now. As ASUU dey hold chalk hostage and government dey do like say nothing dey happen, na the students and their mama for village dey feel am pass. If dem no settle this gbege quick, e fit be say next semester go turn to next year.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
