Confederation of African Football (CAF) don talk say dem get full confidence say Morocco go still host the 2025 Africa Cup of Nations (AFCON) as planned. Dis one follow the recent protest and political tension wey bin raise small fear say the tournament fit shift or change location.
CAF President, Patrice Motsepe, yarn say Morocco don show serious readiness and commitment to deliver world-class AFCON, so dem no dey panic at all. He talk say everything dey on track for preparation.
Motsepe add say, “CAF dey absolutely confident say AFCON 2025 go happen for Morocco without wahala. We believe say dem go make Africa proud.”
Protests No Go Stop Tournament – CAF Stand Gidigba
Despite the protest wey don scatter some parts of Morocco, CAF say dem no see any reason to move the tournament. According to dem, security arrangements and logistics still dey strong, and the Moroccan government don assure say peace go reign before the event begin.
Some football fans for North Africa bin dey worried say unrest fit affect the games, but CAF insist say dem dey monitor everything closely and no cause for alarm.
One official talk say, “Morocco don host big international events before; dem get experience. This AFCON no go different.”
Morocco Government Reassure CAF and Africans
Morocco government too don talk say dem fully ready to welcome Africa come their country for 2025 AFCON. Dem say all stadiums, transport systems, and hospitality sectors dey almost ready.
The Minister of Sports for Morocco say dem no go disappoint Africa, and dem go make sure players, fans, and visitors enjoy world-class experience.
Meanwhile, CAF say dem go continue dey review progress and security measures till tournament kickoff date, but for now, everything dey set.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
