Director-General of National Youth Service Corps, (NYSC) Olakunle Nafiu don come clear am say all corpers now dey fully insured from the moment dem see their call-up letter. According to am, this insurance no be small thing o — e cover both life and health matter throughout the one-year service.
He yarn this gist for Abuja when Jibrin Ndace from Voice of Nigeria carry visit come. Nafiu talk say even before corpers waka comot from house go camp, their insurance don already start to dey active. So if anything sup, dem no go stand alone.
Make we no lie, this one na better update wey go make parents sleep well for night. Before before, na plenty fear dey follow NYSC matter, but with this kind cover, e be like say government dey try reduce the “God abeg” level small.
Millions Don Save Life: Insurance No Be Audio Promise
To show say this insurance no be mouth talk, Nafiu drop some serious examples. One pregnant corper wey get spinal injury, na ₦28 million dem spend take save her life plus her pikin. Another corper wey get accident collect ₦33 million for prosthetic arms. No be play at all.
This kind intervention show say the package actually dey work, no be those promises wey go vanish like NEPA light. E mean say if anything happen, corper fit get real support, not just “we are sorry for your loss” message.
E clear say NYSC dey try package things better, because with this kind money wey dem don spend before, e show say dem ready to stand gidigba for corpers’ welfare. At least, person go serve him fatherland with small peace of mind.
Fake News No Go Help: NYSC Beg Media Make Dem Verify Well
Nafiu still use the opportunity beg journalists make dem dey confirm news well-well with NYSC before dem publish anything. According to am, wrong information fit cause panic wey no necessary, especially for parents and corpers.
He also explain say posting of corpers no be anyhow selection. Dem dey consider national needs plus safety of the corpers. He even add say NYSC no dey do politics or religion matter — their main goal na to unite Nigeria, not to scatter am.
As Voice of Nigeria show interest to partner with NYSC, both sides agree say dem go work together promote better stories about youths and corpers to the whole world. Ndace sef praise Nafiu leadership style, say the man dey run things with modern sense.
At the end of the day, the message clear: corper life no suppose be gamble again. With this insurance in place, NYSC dey try show say dem no just send young people go serve — dem dey ready to back them up if wahala show face.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
