Esther Sky don scatter table as she drop hot take about Big Brother Naija Season 10 housemate, Imisi. According to her, Big Brother house suppose dey about originality and real vibes, but Imisi dey always act like say na scripted show she dey perform.
She yarn say, “Make una help ask una favourite why she dey always pretend for TV. I thought Big Brother na show wey dey reward people for being real, but this girl dey carry fake vibes full house.” Esther Sky no even hide mouth as she declare say she no believe Imisi deserve to win.
Her statement don spark hot reactions online as plenty BBNaija fans don dey argue say maybe Esther dey jealous, while others agree with her say Imisi dey always package herself instead of being natural.
Esther Sky Say Cele Church Vibes No Fit Win BBNaija
The socialite even carry her drag go another level as she throw shade about Imisi lifestyle. Esther Sky talk say person wey dey go Cele church dey pretend holiness for outside, but still dey behave another way for Big Brother house.
According to Esther, this na another reason why she no believe Imisi deserve to carry the Season 10 crown. She insist say Nigerians dey always fall for fake personalities, and if care no dey taken, Imisi go use the same strategy confuse voters.
The matter don scatter BBNaija streets as some fans begin defend Imisi, saying going to church no get anything to do with how person go live for the house. Others still join Esther to shout say pretenders no suppose dey win such reality show.
Esther Sky Warn Fans Say Imisi No Deserve BBNaija Crown
For the final blow, Esther Sky warn BBNaija fans to shine their eyes before voting. She talk say if Nigerians hand over N120 million prize to “fake vibes,” the whole season go lose meaning.
She stress say Big Brother na about truth, originality and vibes, not acting script. According to her, giving Imisi the win go send wrong message to younger generation wey dey watch the show.
Even though plenty of Imisi fans dey drag Esther Sky online, her comment don still trend because e reflect the kind controversy wey dey always follow BBNaija seasons. Whether Esther right or wrong, one thing clear – the fight for BBNaija S10 crown don turn hotter than ever.
Table of Contents
Discover more from OGM News NG
Subscribe to get the latest posts sent to your email.
